Psalms 33pcm

1Una wey dey fear God, make una sing with joy; bikos e dey good make pipol wey get pure heart, praiz am.

2Make una praiz God with di sweet sound from jita; make una use harp take sing to am.

3Make una sing new song take praiz am; make una play di harp make e loud well-well.

4Bikos God word na true and wi fit trust evritin wey E dey do.

5E love anytin wey dey rite and good; God love wey nor dey fail, full di eart.

6Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.

7E gada di sea for one place kon keep di ocean for where e dey.

8So, make di whole world fear God and make evribody kom bless en name.

9Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.

10God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do.

11But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.

12Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.

13God dey look from heaven. E dey from der look all di pipol wey E kreate.

14Evritin wey dey alive for dis eart, God dey look dem from en throne.

15Na-im make dia heart, so E undastand evritin wey dem dey do or tink.

16Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am, na so too pesin pawa nor go fit save am.

17So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win, bikos with all en strent, e nor go fit save yu.

18But God dey guide doz wey dey fear am; doz wey bilive en love wey nor dey fail.

19E save dem from deat and keep dem alive wen honga dey.

20Na God bi awa hope. Na-im dey help and guide us.

21Awa heart dey always happy, bikos of am and wi trust en name wey dey holy.

22My God, make yor love wey nor dey fail, protet us, bikos na Yu bi di hope wey wi get.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 33.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.