Psalms 32pcm

1Di pesin wey God forgive en wiked ways and sins, make e happy!

2Yes, make doz wey God don forgive dia sins happy well-well; doz wey dey live betta life naw!

3Wen I nor gri konfess my sins, my body kon dey die go and I kon dey kry with pain.

4Both day and nite, God just dey ponish mi. My strent die go like wota wey dry, bikos of heat.

5So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!

6So make evribody wey dey fear God pray to am as time still dey, so dat dem nor go sofa for judgement day.

7Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.

8God sey, “I go guide and take yu pass di best road for life. I go advise and wosh ova yu.

9So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”

10Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.

11So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 32.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.