Psalms 20pcm

1Wen yu dey for trobol, make God ansa yor kry for help. Make Jakob God name, save yu from all wahala.

2Make E kom help yu from en temple, den give yu pawa from Jerusalem.

3Make E remember all di gifts wey yu gi-am, den favor yu, bikos of yor ofrins.

4Make E do evritin wey yu wont and make yu prosper for evritin wey yu dey do.

5Make wi shaut for joy wen wi hear viktory sound kon raiz awa banner wey dey show awa God name. Make God ansa all awa prayers.

6Naw, I know sey God dey save di king wey E anoint. E ansa di king from en heaven wey dey holy kon save am with en great pawa.

7Some nashon dey make mout and trust dia shariot and sojas, but na awa Oga God name wi take dey boast.

8Doz nashon go fall skata for groun, but wi go raiz kon stand gidigba for groun.

9God, make Yu give viktory to awa king kon ansa awa kry for help.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 20.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.