Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 20

:
Nigerian - pcm
1 Wen yu dey for trobol, make God ansa yor kry for help. Make Jakob God name, save yu from all wahala.
2 Make E kom help yu from en temple, den give yu pawa from Jerusalem.
3 Make E remember all di gifts wey yu gi-am, den favor yu, bikos of yor ofrins.
4 Make E do evritin wey yu wont and make yu prosper for evritin wey yu dey do.
5 Make wi shaut for joy wen wi hear viktory sound kon raiz awa banner wey dey show awa God name. Make God ansa all awa prayers.
6 Naw, I know sey God dey save di king wey E anoint. E ansa di king from en heaven wey dey holy kon save am with en great pawa.
7 Some nashon dey make mout and trust dia shariot and sojas, but na awa Oga God name wi take dey boast.
8 Doz nashon go fall skata for groun, but wi go raiz kon stand gidigba for groun.
9 God, make Yu give viktory to awa king kon ansa awa kry for help.