Psalms 19pcm

1Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.

2Dem dey show am evriday and for evry nite, dem dey show en greatness.

3Dem nor dey tok out or sey pesin hear dia vois,

4yet dia vois don rish evriwhere for di eart and dia word don pass evriwhere for di world. God don build house for di sun for heaven

5and e dey shine kom out like man wey just marry. E dey happy like pesin wey dey ready to run race.

6Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end and nor-tin fit hide from en heat.

7God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.

8God kommands dey rite and e dey put joy for pesin heart. En kommands dey klear and e dey give pesin hope to stay for dis world.

9To fear God dey good, bikos e dey give pesin hope forever. God laws korrect and dem dey okay.

10Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well. Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.

11Dem dey tish yor savant well and doz wey dey obey dem, go get betta reward.

12So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.

13Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye and nor let sin kontrol mi. Den I go dey innocent and I nor go sin again.

14My Oga God wey bi my Rock and Savior, make di word from my mout and di tins wey I dey tink, dey good for yor eye and sweet Yu well-well.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 19.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.