Bible

Focus

On Your Ministry and Not Your Media

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 19

:
Nigerian - pcm
1 Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.
2 Dem dey show am evriday and for evry nite, dem dey show en greatness.
3 Dem nor dey tok out or sey pesin hear dia vois,
4 yet dia vois don rish evriwhere for di eart and dia word don pass evriwhere for di world. God don build house for di sun for heaven
5 and e dey shine kom out like man wey just marry. E dey happy like pesin wey dey ready to run race.
6 Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end and nor-tin fit hide from en heat.
7 God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.
8 God kommands dey rite and e dey put joy for pesin heart. En kommands dey klear and e dey give pesin hope to stay for dis world.
9 To fear God dey good, bikos e dey give pesin hope forever. God laws korrect and dem dey okay.
10 Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well. Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.
11 Dem dey tish yor savant well and doz wey dey obey dem, go get betta reward.
12 So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.
13 Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye and nor let sin kontrol mi. Den I go dey innocent and I nor go sin again.
14 My Oga God wey bi my Rock and Savior, make di word from my mout and di tins wey I dey tink, dey good for yor eye and sweet Yu well-well.