Psalms 132pcm

1My God, make Yu remember David and all di sofa wey e sofa.

2E make promise give Yu and E vow give di Oga wey bi Israel God sey,

3“I nor go-go my house or go sleep for my bed.

4I nor go gri sleep or let sleep katch mi

5until I find di place where I go build God house put; one big temple for di Oga God wey dey save Israel.”

6Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat; den wi si am for Jaar town.

7Make wi go God temple; make wi woship am for front of en throne.

8My God, make Yu raiz-up kon enter yor place where rest dey, with di Kovenant Box wey dey show yor pawa.

9Make yor glory kover yor priest; make joy full yor loyal savants heart.

10Bikos I bi yor savant, make Yu nor rijet mi David, di king wey Yu choose.

11God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.

12Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.”

13Yes! God don choose Jerusalem; E don choose di town as en own

14and E sey, “I go dey rest for here forever. I go stay der, bikos na mi choose am.

15I go bless dis town kon make am prosper. Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land.

16I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God.

17For der, I go make David pawa strong; bikos I don decide sey, en shidren-shidren go bi king forever.

18I go disgrace en enemies and David kingdom go rule forever.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 132.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.