1Make wi tank God, bikos E dey good and en love dey-dey forever.
2Make evribody for Israel sey: “E dey good and en love dey-dey forever.”
3Make Aaron shidren-shidren wey bi priests sey, “En love dey-dey forever.”
4Make evribody wey dey fear God sey, “En love dey-dey forever.”
5Wen I dey trobol, I pray to God and E ansa kon free mi.
6God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?
7Yes, God dey my side; E go help mi. I go dey happy, bikos I don win di pipol wey hate mi.
8E betta to trust God, dan to trust human being.
9E betta to trust God, dan to trust prince dem.
10Wiked nashons gada around mi, but I distroy all of dem with God pawa.
11Yes! Dem gada round kon attack mi, but I distroy all of dem with God mighty pawa.
12Dem gada mi like bee, but dem die kwik like bush wey dey burn, bikos I distroy all of dem with God pawa.
13My enemies try well-well to kill mi, but di Oga my God save mi.
14Na God dey give mi pawa kon make mi sing new song; E don make mi win all of dem.
15Na songs for joy and viktory dem dey sing for di kamp of pipol wey dey fear and obey God, bikos God don do wonderful tins with en strong rite hand!
16God don win di war with en strong rite hand. Yes! E don do many wonderful tins with en rite hand.
17So I nor go die, instead I go live to tok about all di wonderful tins wey God don do.
18Even doh God don ponish mi well-well, E nor let mi die.
19Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.
20Na dis gate dem dey pass go God present and pipol wey dey obey God, dey pass der enter.
21I dey tank Yu sey Yu ansa my prayers kon make us win,
22bikos di stone wey di pipol wey dey build rijet, don turn to di main stone.
23Dis na God handwork and e dey wonderful for awa eye.
24Dis na di day wey God make, so wi go always dey happy, bikos of am.
25Oga God, wi dey beg make Yu save us! Wi dey beg make Yu make us prosper.
26Make una bless di pesin wey dey kom with God name. Yes! Wi bless Yu from God house.
27Di Oga na God, so make wi start di celebrashon with sakrifice, as wi dey mash round di altar with bambo leaf for awa hand.
28Na Yu bi my God and I go praiz Yu! Na Yu bi my God and I go lift yor name high!
29So make wi tank God, bikos E dey good and en love dey-dey forever.