1I love God, bikos E dey hear my vois and my prayer for help.
2E dey listin to mi, so as long as I dey alive, I go dey pray to am to help mi,
3bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.
4So I koll God name: “Oga God, abeg make Yu kom save mi!”
5Naw, make una si as God kind and good rish! Dis awa God too dey pity for pesin!
6God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat, E kom save mi!
7So my soul go rest again, bikos God dey good to mi.
8Yes! E save mi from deat kon remove tears from my eyes, so dat I nor go fall.
9I dey waka for God present as I dey for dis world!
10I get faith wen I sey, “My God, I bilive Yu, even doh my mind really dey trobol mi.”
11As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!”
12So, wetin I go give God for evritin wey E don do for mi?
13I go dance bikos E diliver mi kon praiz God name forever.
14I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.
15God dey kare for en pipol and E dey pain am well-well wen di ones wey E love, dey die.
16My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.
17So I go tank God with sakrifice kon pray to am.
18Na for pipol present I go for do wetin I vow to God
19and na for God house wey dey Jerusalem. So make wi praiz di Oga wey bi awa God!