Psalms 114pcm

1Wen Israel pipol komot from Egypt; wen Jakob family komot from di land where dem for bi strenja,

2Judah kon bi God temple and Israel kon bi en kingdom.

3Di Red Sea si dem dey kom, kon run and Jordan River turn en face.

4Di mountins jump like goat and di hills run like lamb.

5Red sea! Na wetin make yu dey run? Jordan River na wetin make yu turn yor face?

6Yu mountins, wetin make Yu jump like goat? Yu hill, why Yu run like lamb?

7Yu, eart make yu shake with fear, bikos of di Oga wey bi Jakob God,

8wey turn strong groun to where wota full kon bring wota kom out from strong rock.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 114.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.