Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 114

:
Nigerian - pcm
1 Wen Israel pipol komot from Egypt; wen Jakob family komot from di land where dem for bi strenja,
2 Judah kon bi God temple and Israel kon bi en kingdom.
3 Di Red Sea si dem dey kom, kon run and Jordan River turn en face.
4 Di mountins jump like goat and di hills run like lamb.
5 Red sea! Na wetin make yu dey run? Jordan River na wetin make yu turn yor face?
6 Yu mountins, wetin make Yu jump like goat? Yu hill, why Yu run like lamb?
7 Yu, eart make yu shake with fear, bikos of di Oga wey bi Jakob God,
8 wey turn strong groun to where wota full kon bring wota kom out from strong rock.