1Make una praiz God! Una wey bi God savants, make una praiz am!
2Make praiz bi God name naw and forever!
3Pipol go praiz God name from east go rish west.
4Dem dey praiz am ova all di nashons and en glory high pass di sky for heaven.
5Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?
6E dey bend look di sky and di eart.
7E dey take poor pipol komot from dirty kon remove doz wey nid help from where yeye tins dey,
8so dat E go put dem for where prince dey-dey and dem go dey with en pipol wey bi prince.
9Woman wey nor get pikin, E dey gi-am shidren kon make am dey happy. So, make wi praiz God!