Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 113

:
Nigerian - pcm
1 Make una praiz God! Una wey bi God savants, make una praiz am!
2 Make praiz bi God name naw and forever!
3 Pipol go praiz God name from east go rish west.
4 Dem dey praiz am ova all di nashons and en glory high pass di sky for heaven.
5 Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?
6 E dey bend look di sky and di eart.
7 E dey take poor pipol komot from dirty kon remove doz wey nid help from where yeye tins dey,
8 so dat E go put dem for where prince dey-dey and dem go dey with en pipol wey bi prince.
9 Woman wey nor get pikin, E dey gi-am shidren kon make am dey happy. So, make wi praiz God!