Numbers 25pcm

1Wen Israel pipol dey for Shittim, dem kon dey sleep with Moab wimen.

2Dis wimen invite di pipol kom dia juju festival; den di pipol chop and woship dia juju.

3Bikos Israel pipol join dem woship Baal-Peor, God kon dey vex well-well for dem.

4God tell Moses, “Arrest all di leaders kon hang dem before di Oga for aftanoon, so dat mi God nor go vex for Israel pipol again.”

5So Moses tell di judge dem wey dey Israel sey, “Each of una must kill doz men among una wey dey woship Baal-Peor.”

6At wons, one Israel man bring one Midian woman enter di tent where Moses and di whole kommunity for dey kry.

7Wen Finehas wey Eleazar born, Aaron di priest grand-pikin si am, e komot from where all di pipol gada, take spear

8follow di Israel man enter en tent, den kill di two of dem. So di wahala wey dey distroy Israel pipol kon stop.

9Doz wey die for di wahala na 24,000.

10God tell Moses:

11“Finehas wey Eleazar born, wey bi Aaron di priest grand-pikin don remove my vexnashon from Israel pipol, wen e do dat tin wey e do and naim make mi nor distroy dem wen I dey vex.

12So make yu tell am sey: ‘I go gi-am my kovenant wey dey bring peace.

13Na en get am and en shidren go bi priest forever, bikos e take en God sirious kon make mi forgive dis pipol.’ ”

14Di Israel man wey dem kill with dat Midian woman, na Zimri wey Salu born, wey bi leader for Simeon tribe.

15Di Midian woman wey dem kill, na Cozbi wey Zur born. Zur na leader for Midian tribe.

16Den God kommand Moses,

17“Make yu attack and distroy Midian pipol,

18bikos dem bring wahala to una wen dem deceive una koncerning Peor and bikos of Cozbi, wey die for di time wey Peor bring wahala enter una land.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Numbers 25.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.