Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Numbers 24

:
Nigerian - pcm
1 Wen Balaam si sey God wont make e bless Israel, e nor kon go meet God as before, but e turn waka go near di wildaness.
2 As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.
3 Den e start to profesai: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
4 di man wey dey hear wetin God dey tok. Pesin wey dey si vishon from God, even as en eye open. So e sey:
5 ‘Si as Israel tent fine, di place where Jakob dey stay!
6 Dem bi like long valley; like gardin wey dey near wotaside. Dem bi like aloe wey God plant and cedar tree wey dem plant near wota.
7 Dem go get enough rain and dia shidren-shidren go plenty like river; dia kings go get pawa pass Agag and pipol go praiz dia kingdom.
8 God take dem komot from Egypt. E dey fight for dem like wiked melu. Dem kill and break sturbon pipol bones kon shuk dem with arrow.
9 Di nashon bi like strong lion; wen e dey sleep, nobody fit wake am. Anybody wey bless Israel pipol, go dey bless and anybody wey curse Israel pipol, curse go follow am.’
10 Den Balak kon dey vex well-well for Balaam, so e klap en hand kon tell Balaam, “I koll yu make yu kon curse my enemies, but si, yu don bless dem three times!
11 So naw, make yu dey go! I sey I go pay yu well; but naw, God nor wont make I pay yu.”
12 Balaam tell Balak sey, “I tell di messenjas wey yu send to mi sey,
13 ‘Even if yu give mi yor house with all yor silva and gold, I nor go fit disobey God kommand to do evil or good just as I wont am, but na anytin wey God tell mi, I go tok.’
14 I dey go meet my pipol naw, but make I warn yu about wetin dis pipol go soon do yor pipol.”
15 Den Balaam profesai sey: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
16 di man wey dey hear wetin God tok, wey know di tins wey dey di Most High mind; di one wey dey si vishon from di Almighty, even as en eye open. So e kon sey:
17 ‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.
18 E go take-ova Edom town and propaty; den Israel pipol go win.
19 Dem go bring leader from Jakob house and e go distroy di pipol wey remain for di town.’
20 Den Balaam look Amalek pipol kon profesai: “Before-before, na Amalek strong pass among di nashons, but e go skata forever.”
21 Den e look Kenite pipol kon profesai: “Where una dey stay strong well-well and dey save like bird house on-top tree.
22 But dem go distroy Kenite pipol. How long Asshur go use una as slave?”
23 Den e profesai kon sey: “Yes! Na who go dey alive wen God don do all dis tins!
24 Strenjas go kom from Cyprus kon ovakom Assyria and Eber, but dem too, go die forever.”
25 Den Balaam and Balak kon go dia house.