1Nineveh pipol, somebody dey kom attack and skata una land. So, make una guide una town well-well and wosh una road too! Make una dey strong and ready to fight!
2Judah and Israel pipol bi like tree wey en enemies break en branches, but Oga God go make dem grow again kon give dem glory and pawa.
3Na red dem take paint una enemies shield! Naw, make una si di red klot wey di sojas wear! Make una si as dia shariot dey run togeda and spear dey di sojas hand.
4Di shariot dey run anyhow for di street. Dem bi like tonda lite and dem dey run fast-fast like lite wey flash pass.
5Di king shaut koll en ofisas; dem dey run fall as dem dey rush go guide di town.
6Dem don skata and open di river gate! Di palis go soon fall!
7Dem don disgrace and karry Nineveh pipol go anoda land. Dem don drag dia kween go. En girls savant dey mourn for am; dem dey kry like dove kon dey nak dia chest.
8Nineveh town full with pipol before, but naw, all di pipol don run komot. Even wen somebody shaut, “Make una stop! Make una nor run!” But nobody gri listin to am.
9So naw, make una pak dia silva and gold, bikos Nineveh propaty many well-well! Nobody fit kount di money wey dem get.
10Na wons dem tif and empty evritin for di town kon turn am to where dem dey trow dirty put. Dia heart melt and dia leg kon dey shake. Honga won kill pipol and pipol face don dey shange kolour!
11So wetin don happen to Nineveh, dat great town? Dat place where lion full? Just as lion and en shidren nor dey fear to waka, na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.
12Di lion dey kill wetin e katch kon tear dem to pieces for en wife and shidren. Na flesh full di lion house.
13But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”