Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Nahum 1

:
Nigerian - pcm
1 Dis na di message wey God give Nahum wey kom from Elkosh town and na about Nineveh pipol.
2 Oga God dey jealous well-well; E dey ponish doz wey dey oppoz am and E dey fight against en enemies!
3 Oga God nor dey kwik vex, but en pawa dey great. E go must ponish wiked pipol. E dey show en great pawa thru strong breeze and heavy rain. Na di kloud bi di dust wey dey under en leg.
4 God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.
5 For God present, mountins dey shake and hills dey melt trowey. Wons God appear, di eart go shake and evribody for di world, go fear.
6 Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.
7 Oga God dey good, E dey protet en pipol wen dem dey trobol and E dey kare for doz wey trust am.
8 But E go use heavy rain take distroy en enemies finish kon porshu dem enter darkness.
9 Wetin make una dey plan against God? Na wons E go distroy una finish and trobol nor go happen for di sekond time!
10 En enemies bi like dry shuku-shuku for bush. Yes! Dem bi like pesin wey don drink well-well. True-true, fire go burn dem like dry grass.
11 Na who bi dat wiked pesin for Nineveh wey dey plan against God?
12 So Israel pipol, dis na wetin God tok: “Even doh Assyria sojas get pawa and dem many well-well, I go distroy and skata dem finish for dis world. My pipol! I know sey I don ponish una before, but I nor go ponish una again.
13 Naw, I go skata and distroy Assyria pipol and dem nor go worry my pipol again.”
14 For Nineveh, God tok about Assyria pipol sey: “Una nor go get shidren wey go bear una name again. I go skata and distroy all di gods wey dey una temple and I dey prepare una grave, bikos una dey make mi vex!”
15 Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.