Micah 2
1 E go bad for doz wey nor dey sleep for nite, bikos of di bad tins wey dem dey tink and plan to do. For early morning, dem go rush go do wetin dem plan, bikos dem get pawa to do am.
2 Wen dem wont pesin land, dem go dey find how dem go take seize am and wen dem wont pesin house too, dem dey take am by force. Dem dey opress, shit and take pipol propaty.
3 But dis na wetin God dey tok, “I dey plan to distroy dis pipol and dem nor go fit eskape am. Trobol go follow dem, den dem nor go dey waka with pride again, bikos dat time go bad for dem.”
4 Wen dat time rish, pipol go use una as song take esplain how wahala bi and dem go use una wahala take dey sing sey: “Awa own don finish kpata-kpata! God distroy, take awa land from us kon gi-am to awa enemies.”
5 So wen di time rish to divide land for God pipol, dem nor go give una any part.
6 But di pipol tell mi, “Make yu nor tok like dat. Nor prish like dat, bikos dat kind wahala nor go ever happen to us!”
7 Israel pipol suppose tok like dis? God Spirit go get patient with dis kind karata? But if una go gri do wetin dey korrect, my word go konfort una.
8 But till naw, my pipol dey tok against mi like sey I bi dia enemy! Doz wey trust mi, una tif dia klot kon let dem look like pipol wey dey kom from war.
9 Una porshu wimen from dia house kon take evritin wey God give dia shidren.
10 So make una komot der and dis land nor dey save again, bikos una don use sin skata am finish!
11 If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!
12 “One day, I go gada Israel pipol; I go gada di ones wey remain, just as dem dey gada animals for farm. Yes! Pipol go plenty kon dey make nois for una land again!
13 Una leaders go free demsef and kon free una. From una enemies town, God go take una go back to una own land. Una kings go lead una again and God go guide una by ensef.”