Bible

Elevate

Your Sunday Morning Worship Service

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Micah 1

:
Nigerian - pcm
1 Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.
2 Make pipol for evriwhere listin! Make evribody wey dey for dis world, listin to wetin I dey tok. God wey get pawa dey tok against una and E dey kom judge una from en holy temple.
3 Si! God dey kom from en holy temple for heaven and E go skata all di juju altars for dis world.
4 Den di mountins go melt under en leg like kandol wey melt for fire kon rush enter di valley like wota wey dey rush kom from hill.
5 All dis tins go happen bikos of Israel pipol sturbones and sin. Una ask sey, “Na how wi take sturbon? Na who dem go blame for Israel pipol sturbones?” Nor bi Samaria wey bi di main town! “Where di place wey dem for dey serve juju?” Na Jerusalem dem dey!
6 “So mi wey bi God go turn Samaria to where pipol go dey trowey dirty put and dem go dey plant vine for der too. I go skata en stones for di valley kon espose en foundashon.
7 I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”
8 So, I go kry and mourn. I go just dey waka without klot and shoe. I go jump like jackal kon dey bihave like owl,
9 bikos my pipol sore too deep and e don even rish Judah too. Yes! E don rish Jerusalem gate.
10 Make una nor tell Gat pipol; make una nor let dem si una kry. Make una sidan for groun for Bet-Leafra kon pak san full una head.
11 Una, Shafir pipol, make una naked make shame katch una as dem dey karry una go as slave. Doz wey dey Zaanan nor go try am kom out from dia town. Wen una hear Bet-Ezel pipol dey kry, una go know sey dem nor even get who to help dem.
12 True-true Marot pipol dey wait for who go save dem, but God don bring wahala kom Jerusalem.
13 Lakish pipol, make una karry una horse and propaty run. Na una bi di first town for Judah wey join Israel pipol sin and una kon make Jerusalem pipol, sin too.
14 So, make una tell Moreshet-Gat town bye-bye. Na Akzib pipol deceive Israel king.
15 Maresha pipol, God go give una to una enemies wey go katch and skata una town. Den Israel leaders go-go hide for Adullam town.
16 Judah pipol, make una mourn and shave una hair, bikos dem go karry di shidren wey una love go as slave. Make una skrape una head like vulture own, bikos dem go karry una small-small shidren go work as slave for anoda land.