Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Lamentations 2

:
Nigerian - pcm
1 God disgrace Zion bikos E dey vex. E don trowey Israel pride from heaven kom down and E nor protet di temple again bikos E really dey vex with dem.
2 God nor sorry for Jakob shidren-shidren, instead E distroy dia house. Wen E dey vex, E break Jerusalem strong fine wall kon disgrace di kingdom with doz wey dey rule am.
3 E vex distroy Israel pipol pawa; E nor gri help Israel wen dia enemies kom attack dem. Just as fire dey distroy tins, na so too E distroy Israel land.
4 E set arrow kon shot us like sey wi bi en enemies. Yes, en rite hand dey ready to shot. E kill us with awa strong men kon pour en vexnashon like fire for Zion head.
5 God distroy Israel like sey E bi awa enemy. E distroy all di palis dem kon skata awa betta towns. E make evribody for Judah kry and mourn.
6 E distroy en temple like sey na vineyard kon skata where wi for dey woship am. God make Zion pipol forget dia festival and Sabat Day. Naw, kings and priests don fall, bikos E dey vex.
7 God rijet en own altar kon hate en temple. E allow enemies distroy di walls and dem kon dey shaut inside di temple like sey dem dey do party.
8 God won distroy Jerusalem fine wall. E dey plan to distroy am and E go do wetin E plan. Den E go skata di towas and di walls rish groun.
9 Di town gates don sink enter groun. E skata all di keys and bars wey dem take dey lock di gates. Dem take en prince dem and kings go Babilon as slave. Law nor dey again and God profets nor dey get any vishon from am again.
10 Jerusalem leaders sidan kwayet for groun. Dem wear sak klot kon pak dust put for dia head and di yong wimen kover dia face for groun with shame.
11 I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.
12 Dem dey kry give dia mama sey, “Wi wont chop and drink!” Dem dey faint for di town like sojas wey wound for war and dem dey die small-small for dia mama hand.
13 Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?
14 Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.
15 Pipol wey dey pass di town dey look una with shame. Dem dey laf and shake dia heads, bikos Jerusalem don skata. Dem sey, “Nor bi di fine town wey di world bin like well-well bi dis?”
16 All yor enemies dey laf and happy sey, “At last, wi don distroy am! Wi don dey wait for dis day since and naw, e don kom.”
17 But na God do wetin E plan. E don do wetin E promise and E warn us about am since. E nor sorry for Jerusalem kon distroy am. E give awa enemies viktory and dem dey happy, bikos God don distroy us.
18 Jerusalem wall wey fine well-well, make yu kry give God! Both day and nite, make di wota from yor eye dey flow like river! Make yu nor rest or stop to kry!
19 Wake-up for nite, make yu kry. Pour all yor heart like wota before God! Raiz yor hand as yu dey pray to am and dey beg for yor shidren wey dey faint, bikos honga won kill dem.
20 Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?
21 Si yong and old pipol don die for di street. Enemies don kill both boys and girls. Yu don kill dem, bikos Yu dey vex and Yu nor sorry for dem wen Yu dey kut dem.
22 Just as dem dey invite pesin for party, na so too Yu invite my enemies and I kon dey fear. For di day wey God dey vex, nobody go fit eskape or survive am. Naw, my enemies don kill all di shidren wey I born and train.