Bible

Focus

On Your Ministry and Not Your Media

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Jonah 2

:
Nigerian - pcm
1 As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.
2 E sey, “I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, so make Yu go kom help mi and hear my prayers.
3 Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.
4 Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’
5 Di wota kover and almost kill mi. Naw, I don sink enter di sea. Even di leaf dem wey dey di sea, don tie my head.
6 I sink go under di mountins kon enter inside one place where I go bi prisona forever. But Yu, my God don take mi komot from di pit.
7 Wen I tink sey my life don dey finish, I kon pray give Yu and Yu hear mi from yor holy temple.
8 Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.
9 But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”
10 Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.