Jonah 2pcm

1As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.

2E sey, “I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, so make Yu go kom help mi and hear my prayers.

3Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.

4Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’

5Di wota kover and almost kill mi. Naw, I don sink enter di sea. Even di leaf dem wey dey di sea, don tie my head.

6I sink go under di mountins kon enter inside one place where I go bi prisona forever. But Yu, my God don take mi komot from di pit.

7Wen I tink sey my life don dey finish, I kon pray give Yu and Yu hear mi from yor holy temple.

8Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.

9But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”

10Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jonah 2.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.