Jonah 1
1 One day, God tell Jonah wey bi Amittai pikin
2 sey, “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol about my judgement wey dey kom, bikos I don hear how di pipol for der wiked rish.”
3 But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.
4 But God send strong breeze go kause wahala for di sea and bikos di breeze strong well-well, di ship won kon break to pieces.
5 Di sailors kon dey fear; evribody bigin kry kon dey pray to dia difren juju. Den dem kon dey trowey dia load for wota make di ship for lite. By dis time, Jonah dey inside-inside di ship dey sleep.
6 Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”
7 So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am.
8 Dem kon sey, “Make yu tell us! Na who make dis tins dey happen to us so? Na wish kind work yu dey do? Where yu from kom? Wetin bi yor kountry name and wish tribe yu bi?”
9 Jonah ansa, “I bi Hibru pesin! I dey woship God; di Pesin wey make heaven, land and sea.”
10 Wen dem hear wetin e tok, fear kon katch dem well-well, so dem ask am, “Wish kind tin yu do so?” Di men tok like dis, bikos dem know sey e dey run from God, just as e bin tell dem.
11 Bikos di breeze dey strong more-more, dem kon ask am, “Wetin wi go do yu naw make dis breeze for stop?”
12 Jonah ansa, “Make una trow mi inside di wota and di breeze go stop. Bikos na mi kause dis wahala for una.”
13 Instead, dem kon try to padol di ship go land back, but dem know fit, bikos di breeze strong well-well.
14 So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.”
15 So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.
16 Dis tin make di men fear God well-well, so dem offa sakrifice gi-am kon promise to serve am.
17 So God send one big fish go swallow Jonah. Jonah dey di fish belle for three days and three nite.