Job 41pcm

1“Yu fit use fish hook take katch Leviatan or use rope take tie en tongue?

2Yu fit put rope pass en nose or hook en jaw?

3E go beg yu make yu let am go? Or make e beg yu make yu sorry for am?

4E go gri make agriment with yu kon promise sey e go serve yu forever?

5Yu go fit tie am like bird wey dem dey train for house; or like sometin wey go sweet yor wimen savant to play with?

6Pipol wey dey katch fish go gri follow am enter agriment? Pipol wey dey sell pesin go gri sell am?

7Yu go fit tosh en skin with spear wey dem take dey katch fish or katch en head with hook?

8Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight!

9Anybody wey si Leviatan go fear fall for groun.

10Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front.

11Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own?

12Make I tell yu about Leviatan leg kon tell yu how e dey big and strong well-well.

13Nobody fit tear en klot wey dey outside or shuk di armour wey e wear.

14Who fit open en mout or bring en tit wey dey make pesin fear, kom out?

15Na many shield dem take make en back kon tie dem togeda and dem strong like stone.

16Dem join dem strong well-well and space nor dey wey breeze fit pass enter en body.

17En body strong well-well and nor-tin fit tear am En body join togeda and nor-tin fit separate dem.

18Wen e sneeze, lite go flash kom out and na so en eye dey shine like sun for aftanoon.

19Fire and tonda lite dey kom out from en mout.

20Like grass wey dey burn under pot, na so too smoke dey kom out from en nose.

21Fire dey kom out from en mout and even wen e breath, e dey bring fire.

22En neck get strong pawa wey fit make evribody wey near am, fear.

23E nor get any weak part for en skin; e dey strong well-well and e bi like iron wey dem nor fit bend.

24En heart bi like stone wey nor dey fear anytin; e dey strong well-well like grindin stone.

25Wen e stand, even pipol wey strong well-well, dey fear and di fear dey make dem shake anyhow.

26No swod fit wound am; no spear or arrow fit enter en body.

27Iron just bi like straw for en eye and bronze dey soft like wood wey don rotin.

28E nor get di arrow wey won make am run, even wen dem stone am with rock, e bi like straw for en body.

29Spear bi like straw to am and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am.

30Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break; as e dey waka, e dey leave mark for di mud like sey e won separate di groun.

31E dey shake di sea like wota wey dey boil kon make am dey dance like oil for pot.

32E dey leave shine-shine part for en back kon make di sea get white foam.

33E nor get anytin for eart wey yu fit take kompare am and I kreate am without fear.

34Even di animal wey dey karry body up, e dey look dem like nor-tin; bikos naim bi king among all animals.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 41.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.