1Den God tell Job:
2“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
3Den Job ansa God:
4“True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.
5I don tok pass wetin I suppose tok. I nor get anytin to tok again?”
6Den from inside di storm, God kon ansa Job:
7Make yu stand strait kon ansa my kweshons.
8Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
9Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?
10If na so, stand up make yu ansa mi; dress like king make yu hail yorsef.
11Look pipol wey tink sey dem dey important, den go honbol dem, bikos yu dey vex.
12Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put.
13Beri all of dem for groun kon tie dem for where dead body dey.
14Den na mi go first praiz yu kon gri sey yu don win di fight by yorsef.
15Si Behemot; I make am di way I make yu, e dey chop grass like melu,
16but si as en strent bi like lion own and e pawa dey en body.
17En tail stand like tall tree and di pawa wey dey e leg, strong well-well.
18En bones strong like bronze and en leg bi like iron bar.
19E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol! Na only God wey kreate am go fit distroy am.
20Grass wey dem go chop, dey grow for di hill wey bush animals dey for play.
21E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass and e go hide among di reeds for di bush.
22Inside bush dey gi-am betta place to rest. Di tall tree dey gi-am shade.
23E nor dey fear wota wey dey rush pass like river; en body go kold wen Jordan River flow pass en face.
24Who fit blind en eyes kom katch am? Na who fit use trap katch am thru en nose and mout?