Job 31pcm

1“I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.

2Wetin God for heaven choose for us? Wetin wi go gain from di Almighty wey dey heaven?

3Shebi trobol na for doz wey dey do bad tins and wahala for wiked pipol?

4God know evritin wey I dey do; E dey si evry step wey I dey take.

5I neva do wiked tin before and I neva ever lie to anybody.

6Make God just test mi weda I dey klean and E go si sey I nor do any bad tin.

7If I don komot from di rite way; if my heart don follow wetin my eye si or if sin full my hand,

8den make anoda pesin chop wetin I plant. Make dem rut and distroy evritin wey I plant.

9If I dey like and won sleep with woman for my heart kon dey wait and hide outside en door,

10den make my wife kook for anoda man chop and make e sleep for anoda man bed.

11Bikos dat go bi big shame and na deat dem take dey ponish dat kind wikedness.

12Make e bi like hell-fire wey dey distroy tins; fire wey go burn evritin wey I get.

13If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.

14If I nor dey do dem well, how I won take face God? Wetin I won tok if God kom judge mi?

15Na di same God wey kreate mi, kreate my savants too.

16I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain

17or allow shidren wey nor get papa and mama dey hongry, while I dey chop.

18Na since wen I small I don dey kare for doz wey nor get papa and mama and till I die, I go always dey kare for wimen wey dia husband don die.

19If I si pesin wey nor get at-all; wey won die, bikos e nor get wetin to wear,

20I go gi-am klot wey dem use my own animal wool take make. Den e go tank mi with en hold heart.

21If I don ever do bad to who nor get papa and mama, bikos I know sey I go win di matter wen wi go kourt,

22den make my hand break. Make e break komot from my shoulder.

23But bikos I dey fear God ponishment, I nor fit do dat kind tin.

24I neva ever bilive money. I nor ever si am as wetin go protet mi

25or kom dey karry body, bikos of di money wey I get.

26I neva ever woship sun, bikos e dey give lite or di moon, bikos e fine.

27I neva for one day like dem rish wen I go kon dey kiss my hand dey woship dem.

28Na deat dem take dey reward dat kind sin; bikos e go mean sey I nor honor God name.

29I neva happy wons, bikos my enemies dey sofa; or dey for peace, bikos dem dey face trobol.

30I neva ever pray make dem die, bikos if I do like dat, God nor go forgive mi.

31My savants neva ever sey, ‘Awa oga let hunga kill some pipol.’

32Doz wey dey travel, I dey koll dem enter my house and I nor dey let dem travel or sleep for road wen nite rish.

33Oda pipol dey try to hide dia sin, but I neva ever hide my own.

34I nor dey kwayet or stay for inside house, bikos I dey fear sey pipol go curse or tok against mi.

35“Nobody won listin to wetin I dey tok? I swear sey evry word wey I dey tok na true. Make God kom ansa mi. Make dem rite wetin my enemies tok about mi, so dat I go si dem.

36I go karry dem without shame for my shoulder kon wear dem like king crown.

37I go dey proud to tell God evritin wey I don do. I go waka go meet am like prince.

38“If I tif di land wey I for dey farm or take am from di original owner,

39or chop di food wey grow for der, so dat di owner nor go si chop,

40den instead of fruit or korn to grow, make bush and grass grow full dat land!” Den Job kon stop to dey tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 31.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.