Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Job 30

:
Nigerian - pcm
1 “But pipol wey yong pass mi dey laf mi naw! Pipol wey dia papa nor dey yuzful, wey I nor go even allow join di dogs wey dey guide my sheep.
2 Dem bi yuzles pipol and dem too weak to do any work for mi.
3 Bikos dem poor well-well and honga won kill dem, dem kon dey chop dry rut and dirty for nite.
4 Dem dey pul and chop plant for desert; even di small tree wey en rut nor get taste, dem dey chop am too!
5 Evribody dey shaut follow dem like tif kon porshu dem komot from di land.
6 Dem dey stay for inside hold wey en wota don dry and inside rock too.
7 Dem dey bihave and shaut like animals and gada togeda for bush.
8 Dem nor get sense or name and dem porshu dem komot di town.
9 “Naw, dem dey kom laf and take mi sing. Na mi dem dey take do joke naw.
10 Dem dey trit mi like sey I dey smell; dem feel sey dem too good pass mi, so dem kon spit for my face.
11 Bikos God don make mi weak and I nor get who go help mi; dem kon use all dia vexnashon take face mi.
12 Dem gada kon fight mi; dem drive mi from one place to anoda and dem don agri for wetin dem go do mi.
13 Dem follow mi as I dey run kon dey try to distroy mi and e nor get who fit stop dem.
14 Dem kon attack mi from difren angle. Dem jump press mi wen I don already fall.
15 Fear don chop my full body; my respet don go like wota proof wey breeze blow and my glory don vanish like kloud.
16 “I won die naw; bikos na so-so pains full my days.
17 Di nite dey make my bones pain mi; di pains dey bite mi and e nor gri stop.
18 God hold mi for neck with pawa kon make di klot wey I wear, dirty.
19 E trow mi for mud and naw, I bi like dust and ashes.
20 God, I dey koll Yu, but Yu nor gri ansa and wen I pray, Yu nor gri listin to my prayers.
21 Yu dey do mi anyhow; Yu dey ponish mi with all yor pawa.
22 Yu allow breeze blow mi go; Yu trow mi up-and-down for inside strong breeze.
23 I know sey Yu dey karry mi go where I go for die; di place wey Yu keep for evribody.
24 “True-true, nobody go fight poor pesin, wen e kry sey make dem help am from en trobol.
25 Abi I nor follow pipol wey dey trobol kry kon sorry for pipol wey nor get at-all?
26 Na happiness and lite I dey hope for, but na trobol and darkness I kom get.
27 Pain and worry don skata my body; I dey sofa evriday.
28 I just dey waka for darkness and I nor dey si lite at-all. I dey beg for help for where crowd Gad put.
29 I don kry sotey my vois don krack and my neck don long like Ostrich own.
30 My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.
31 I nor fit remember di last time wen I hear betta music, bikos na only song wey go make mi mourn and kry, naim dem dey play.