1God sey, “I go distroy Babilon and en pipol with strong breeze.
2I go send strenjas kom distroy Babilon like breeze wey blow dirty trowey. Wen dat day rish, dem go attack dem from difren side, until di land go empty.
3Dem nor go give Babilon sojas time to even shot arrow or wear dia war klot. Dem nor go sorry for Babilon yong men and dem go distroy all dia sojas.
4Dem go wound kon fall die for all di street wey dey dia towns.
5Mi, God wey dey mighty, neva forget Israel and Judah pipol, even doh dem sin against mi wey bi di holy God for Israel.
6So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.
7Babilon pipol bi like gold cup for my hand a nd di wine for inside dey shark di whole world. Di nashons drink from am and dem kon start to bihave anyhow.
8But na wons Babilon fall kon skata. Make una mourn for am! Make una find medicine for am, may bi dat one fit cure am.
9Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”
10God sey, “My pipol, make una shaut sey: ‘God don show sey wi dey do di rite tin. So make wi go tell doz wey dey Jerusalem wetin God do for us.’
11So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!
12Make una give sign make dem go attack Babilon. Give di guide pawa kon put dem for dia pozishon, den una go hide some men for bush too!’ God don do wetin E sey E go do to Babilon pipol.
13Una wey dey stay along Babilon river, una end don near well-well. Una wey rish well-well with propaty wey una tif, dis na di time to kill una.
14God wey dey mighty, don swear with ensef sey, E go bring many pipol kon attack Babilon like ant and dem go shaut dey happy.”
15God make di eart with en pawa; na en wisdom E take kreate di world kon spread di heavens with en sense.
16Wen E kommand, di wota on-top sky dey make nois like wen lion dey shaut. E make di kloud kom out from di rite place. E make lite kom out for rainin sizin kon send breeze kom from where E keep dem put.
17Wen pipol si dis tins, dem dey bi like fool wey nor get sense. Doz wey dey make juju, na di juju dey disgrace dem; di gods wey dem make, nor bi betta god and e nor even get life.
18Dem dey yuzles and pipol dey use dem make yeye. Den wen di time rish, God go distroy all of dem.
19Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. Na God wey get pawa, bi en name.
20God sey, “Babilon pipol, una bi my hammer and swod wey I dey use take fight. I use una take skata nashons and kingdoms.
21I still use una take skata horse, shariot and di pipol wey dey ride dem.
22Na so too, I use una take kill men and wimen; kut both old and yong pipol and kill boys and girls too.
23I still use una take kill shepads and dia animals; kill pipol wey dey tif and dia horse; den skata rulers and ofisas.
24But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol for all di bad-bad tins wey dem do to Jerusalem.
25Babilon! Yu bi like mountin wey distroy di whole world, but mi wey bi God, na una enemy. I go katch, skata and burn una to ashes.
26Di stone wey skata for una town, una nor go fit use am take build house again. Una go bi like desert forever.
27Make una give dem sign to attack! Make una blow trumpet, so dat di nashon go hear! Ready di nashons, so dat dem go fight against Babilon pipol! Tell Ararat, Minni and Ashkenaz kingdom make dem attack Babilon. Make una choose one offisa wey go lead dem go attack and bring all di horse kom back like many ant.
28Prepare di nashons make dem go fight against Babilon pipol. Send messenjas make dem go koll Media kings, dia leaders, ofisas and di sojas for all di kountries wey dem dey kontrol.
29Di eart dey fear and shake, bikos God dey do wetin E plan wen E sey E go turn Babilon to desert where pipol nor dey stay.
30Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.
31Difren messenjas go run go tell Babilon king sey dem don break en town enter from difren korna.
32Enemies don seize di river wey dem dey pass kon burn all dia strong and betta house and Babilon sojas dey fear well-well naw.
33E nor go tey before enemies go kut dem for groun like korn wey dem dey pick for farm. Mi, wey bi Israel God wey dey mighty, don tok.
34King Nebukadnezzar for Babilon don skata, chop and distroy my town like empty cup. E swallow am like wiked animal and na awa propaty full en belle. E still porshu us komot from awa own land.
35Zion pipol sey, ‘Just as Babilon pipol sofa us, na so too God go sofa dem and make God pay dem back, bikos dem kill awa pipol.’ ”
36Dis na wetin God tell Jerusalem pipol: “I go bi una lawyer kon judge una kase, den I go fight for una. I go dry Babilon rivers.
37Babilon go turn where dem dey trowey dirty put and trobol go dey follow am. Pipol go fear and hate dem and nobody go stay der again.
38En pipol go shaut like lion wey dey find food; like lion shidren wey dey hongry.
39As dem dey hongry, I go prepare food, so dat dem go chop and drink kon happy. Den dem go sleep kon die go like dat.
40I go karry dem go kill like lamb, goats and rams.”
41God tok about Babilon sey: “Dem don seize di town wey di whole world dey praiz! Naw, e don turn where nashons dey fear to stay.
42Di sea rush enter Babilon and naw e don kover di town.
43Di town don turn where pipol dey fear to stay and e bi like desert wey nor get wota; where pipol nor dey stay or travel pass.
44I go ponish Bel wey bi Babilon god and make am drop all di tins wey e tif and di nashons nor go woship am again. Naw, Babilon wall don fall.
45So Israel pipol, make una run komot from der! Make una run for una dear life and from my vexnashon.
46Make una nor fear or luz hope, bikos of wetin una hear. Dem go dey tok difren tins evry year about fight for di land and dem go sey one king dey fight anoda one.
47So di time dey kom wen I go deal with Babilon juju. Di whole kountry go shame and dem go kill all en pipol.
48Den evritin wey dey heaven and eart go dey happy wen Babilon pipol go fall, wen doz sojas from nort don distroy dem.
49Na Babilon kill many pipol for dis world. Yes! Babilon go fall, bikos na-im make many Israel pipol die. Mi, wey bi God, don tok.”
50God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”
51Di pipol sey, “Wi dey shame, dem don insult and disgrace us, bikos strenjas don dirty God temple.”
52God sey, “Yes! Di time dey kom wen I go distroy all Babilon juju and for evriwhere for di land, dem go dey hear doz wey wound dey kry bikos of dia pain.
53Even if Babilon klimb go sky kon build strong house for der, I go still send pipol go distroy am. Mi, wey bi God, don tok.”
54God sey, “Make una listin as dem dey kry for Babilon town. Dem dey mourn, bikos of how dem distroy di land.
55I go distroy Babilon and nobody go hear en vois again. Sojas go rush kom attack dem like wota for sea and dem go sey,
56‘Wi don distroy Babilon. Wi don seize en sojas kon break dia bow.’ I bi di God wey dey ponish bad pipol and I go pay Babilon back.
57I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.
58Dem go distroy Babilon strong wall kon burn dia big-big gate. Evritin wey Babilon build, go skata go like dat.”
59Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah.
60Evritin about di distroshon wey go happen to Babilon pipol and some oda tins about Babilon, I rite dem down for book.
61Den I tell Seraya, “Wen yu rish Babilon, make sure sey yu read evritin wey I rite loud make evribody for hear yu.
62Den make yu pray sey, ‘Oga God! Yu don sey Yu go distroy dis place and pipol or animals nor go stay der again and e go dey empty forever.’
63Seraya, wen yu don read dis book finish for di pipol, tie am for stone and trow am inside Eufrates River kon
64sey, ‘Dis na wetin go happen to Babilon. E go sink and e nor go raiz-up again, bikos of di way God go distroy am.’ ” Na here Jeremaya message for finish.