Jeremiah 50
1 God tok thru Profet Jeremaya about Babilon and en pipol. E tell am sey,
2 “Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.
3 Na from nort one nashon go kom attack and distroy Babilon. Babilon go turn desert where nobody dey stay, bikos en pipol and animals go run komot der.’ ”
4 God sey, “Wen dat time rish, Israel and Judah pipol go kry kom find mi wey bi dia God.
5 Dem go ask kon follow di road wey dem dey pass go Zion. Dem go make kovenant wey nor dey end with mi and dem nor go break am.
6 My pipol bi like sheep wey waka lost. Who dey guide dem don make dem lost. Dem dey waka anyhow for di mountins; dey from one hill go anoda. Dem don forget dia place where rest dey.
7 Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’
8 So Judah pipol, make una kwik-kwik komot from Babilon! Make una bi di pipol wey go first komot from der. Make una bi like man goat wey dey lead di oda goats.
9 Bikos I dey bring many strong nashons from di nort and dem go attack and distroy Babilon. Wen dia strong sojas shot dia arrow, e go-go meet and kill who dem shot am to! Dem nor dey miss at-all.
10 Dem go tif and karry evritin wey dey Babilon. Mi, wey bi God, don tok.”
11 God sey, “Babilon pipol! Una tif from my pipol and e dey make una happy. Una dey enjoy like animal wey dey chop betta green grass. Una dey sing with joy like di nois wey horse dey make.
12 But dem go disgrace una and shame go katch dis great town. Babilon go bi last among nashons wey dem dey fear; e go dry kon turn empty desert.
13 Afta I don vex ponish Babilon, nobody go stay der again. Dem go distroy am finish. Doz wey dey waka pass go si am kon sopraiz well-well, bikos of di wahala wey don happen to am.
14 All di sojas, make una ready to attack Babilon. Make una shot una arrows against di town, bikos dem don sin against God.
15 Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.
16 Make una kill all di farmer wey dey plant for di town. Make all di strenjas go back to dia own pipol. Make dem rush go back to dia land, so dat doz wey dey attack, nor go kill dem join Babilon pipol.”
17 God sey, “Israel pipol bi like sheep wey run skata for evriwhere bikos lion dey porshu dem. Assyria king first attack and kill dem, before King Nebukadnezzar for Babilon kon break dia bones.
18 Bikos of dis, just as I ponish Assyria king, na so mi wey bi Israel God go ponish King Nebukadnezzar and en pipol.
19 I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.
20 Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life. Mi, wey bi God, don tok.”
21 God sey, “Make una go attack, kill and distroy Merataim and Pekod pipol! Make una do evritin wey I kommand una.
22 Dem go hear war nois for Babilon. Pipol go hear as dem dey distroy Babilon towns.
23 Before, Babilon pipol skata di whole world. But naw, dat hammer wey dem use, don skata. Pipol shok as dem si wetin happen to di kountry.
24 I set trap for Babilon and e katch dem, before dem know. Una fight against mi and na dis make dem katch and distroy una.
25 I don open di place where I keep my swods and war tins put. I don karry di swod wey I go take distroy, bikos mi, di Oga God wey dey rule evritin, get work to do for Babilon.
26 Make una from far kom attack Babilon! Skata where dem keep dia food put! Gada am like dirty kon distroy am finish! Make una kill evribody wey dey der!
27 Make una kill all dia sojas anyhow! Babilon pipol own don finish, bikos di time don rish wen I must ponish dem.
28 (Make una listin! Pipol wey nor get house dey run komot from Babilon go Jerusalem kon tok as di Oga awa God ponish Babilon pipol, bikos of wetin dem do to en temple.)
29 Tell di sojas make dem attack Babilon. Make evribody wey sabi shot bow, surround di town so dat nobody go eskape. Una must pay dem back kon trit dem, just as dem trit odas, bikos dem dey karry body for mi wey bi di Holy One for Israel.
30 For dat day, dem go kill all di yong men for di town and all dia sojas go die too. Mi, wey bi God, don tok.”
31 God sey, “Babilon pipol, bikos una too karry body, mi wey bi God, dey against una! Time don rish wen I go ponish una.
32 Nashon wey dey karry body up, go fall skata and nobody go help am. I go set fire for una town kon distroy evritin.”
33 God wey dey mighty sey, “Dem dey opress Israel and Judah pipol. Doz wey katch dem don turn dem to prisonas. Dem nor gri let dem go.
34 But di Pesin wey go save dem, dey strong. Dem dey koll am Oga God wey dey rule ova evritin. E go fight for dem kon bring peace and rest kom di eart, but na trobol, wahala and pain go follow Babilon pipol.”
35 God sey, “Babilon go skata! En pipol, rulers and wise men, go die finish.
36 Dem go distroy en profets wey dey lie and pipol go si dem as fools! En sojas go dey die and fear go turn dem to mumu.
37 Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
38 Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.
39 E nor go tey before wild animals go kom take Babilon land and di town go turn where birds dey stay. Pipol nor go ever stay der again and e go dey empty forever.
40 Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns, na so too e go bi for Babilon. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.
41 Si, strong sojas dey kom from nort. One strong nashon and many kings dey kom attack dem from far.
42 Dem karry dia bow and swod; dem wiked and nor dey sorry for pesin. Di nois wey dia horse dey make, bi like river own. Dem dey ready to fight against Babilon pipol.
43 Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok. Wen e hear sey dem dey kom, fear and pain go nearly kill-am like woman wey won born.
44 Like lion wey kom out from bush near Jordan, na so too, mi wey bi God go kom attack and porshu Babilon pipol komot from dia town. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos nobody bi like mi and who go fit shalenge mi? Wish ruler fit follow mi make mout?
45 So make una listin to di plan wey I get against Babilon town and en pipol. Dem go drag dia shidren go like sheep kon skata dia house.
46 Wen Babilon fall, di eart go shake and oda nashon go hear as Babilon pipol dey kry with pain.”