1God sey, “Israel pipol, if una really wont turn back kom meet mi, make una distroy all una juju,
2den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”
3God tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una too sturbon! Una heart too hard like strong groun wey shuku-shuku full, wey farmer neva dig.
4Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
5God sey, “Blow di trumpet for di land! Shaut kon gada evritin togeda! Den tell Judah and Jerusalem pipol sey, make dem run go stay di strong towns.
6Show dem where dem go pass run go Zion. Make dem run kwik-kwik, so dat dem go dey save! Bikos God dey bring wahala kom from nort and E go distroy well-well.
7Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”
8So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.
9God sey, “For dat day, di mind wey kings get, go fail dem! Priests and profets go dey shek with fear.”
10Den I sey, “God wey get pawa, wetin make Yu deceive Jerusalem pipol? Yu bin sey peace go dey, but naw, Yu dey ready to kill.
11“For dat time, dem go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “ ‘I dey kommand one strong breeze kom from di desert kom meet my pipol. Di breeze nor bi to blow well or to klean my pipol,
12and dis breeze go strong well-well! Bikos na only God dey judge en pipol.’
13Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”
14“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
15From Dan town, one vois dey shaut dey kom and e dey bring bad news kom from Efraim hill.
16E don kom warn di nashons and tell Jerusalem pipol sey, ‘Wiked sojas dey kom from one far kountry kon tok against Judah town.’
17Just as pipol dey guide farm, na so di wiked men go surround Jerusalem, bikos en pipol tok against Mi.” God don tok.
18Judah, na una kause dis wahala, bikos una dey live yeye life kon dey do bad tins. Na una sin kause dis sofa and e go pain una enter una heart.
19Den I sey, “I nor go fit bear dis pain! My heart dey beat fast-fast! I nor fit kwayet, bikos I hear di trumpets and war nois.
20I hear as wahala dey happen for evriwhere! Di whole land don skata finish. Yes! Na wons dem distroy awa tent kon tear awa curtains to pieces.
21Na how long I go dey si awa enemies war flag and hear dia trumpet sound?”
22But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
23I look di eart kon si sey e empty and nor get shape; I look di sky and dia lite kon vanish.
24As I look di mountins, dem dey shake like man wey dey fear and all di hills dey go back and front.
25I look kon si sey nobody dey der and di birds for di sky don fly komot.
26Di land wey dey fruitful before, don empty and evribody dey sofa, bikos of God vexnashon wey dey burn like fire.
27God sey, “Di whole land go turn desert and I go distroy am finish.
28Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”
29Evribody for di land go run wen dem hear di shariot sound kon si sojas with dia bow and arrow. Some go run go hide for forest; odas go klimb mountin go hide for rocks. Di towns go empty and nobody go remain for der again.
30Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.
31I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”