Jeremiah 19pcm

1God tell Jeremaya, “Make yu take some leaders and priest go buy pot wey dem take klay make.

2Make una pass Potsherd Gate go Ben-Hinnom Valley. Den yu go tell dem wetin I tell yu, for der.

3“God sey, ‘Judah king and Jerusalem pipol, make una listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok: I go bring wahala kom dis place and anybody wey hear about am, go fear!

4I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.

5Dem build altar for Baal juju, so dat dem go fit sakrifice dia shidren gi-am. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.

6So mi wey bi God dey sey, “Time dey kom wen pipol nor go koll dis place Tofet or Ben-Hinnom Valley again, but dem go dey koll am, di Valley Where Dem For Dey Kill Pipol!”

7Na for der I go for skata di plan wey Judah and Jerusalem pipol dey plan. I go make dia enemies win kon kill dem for war and birds with wiked animals go chop dia dead body.

8I go distroy dis place well-well. Pipol wey dey pass go shok and shake dia head, bikos of wetin happen.

9Wen dia enemies surround di town won kill dem, I go make dem chop dia shidren and dem go still chop each oda too.’ ”

10God still sey, “Naw, make yu break di pot for di pipol front

11kon tell dem, ‘Oga God wey dey mighty sey, “Just as Jeremaya take distroy dis pot, na so too I go distroy dis town and di pipol wey dey stay inside. Dem go beri pipol for Tofet, until place nor go dey again to beri pipol put.

12I don promise and I must make dis town and di pipol, bi like Tofet.

13Di house for Jerusalem; Judah king house and di pipol house wey dem for don burn incense give di stars kon pour wine as ofrin give oda gods, all of dem go dirty, just as Tofet dirty.” ’ ”

14Den, Jeremaya komot from Tofet where God for tok to mi kon go stand for di kourt wey dey di temple front, den tell all di pipol wetin

15Israel God wey dey mighty tok: “I go soon ponish dis town and di oda towns wey surround am, bikos una sturbon well-well and una nor gri listin to wetin I tok.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 19.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.