Jeremiah 18pcm

1God tell mi,

2“Make yu go di house wey dem for dey make pot and I go tok to yu for der.”

3So I go der kon si di man wey dey make pot wen e dey mold one pot.

4But wen e si sey di tin wey e dey mold nor good as e wont, e skata am kon start again.

5Den God tell mi,

6“Israel pipol, I nor get rite to do una wetin di man wey dey mold pot dey do with di klay? Just as klay dey di pesin wey dey make pot hand, na so too una dey my hand.

7If I sey I go rut, break or distroy any nashon or kingdom

8and dat nashon stop to dey disobey mi, I nor go do wetin I bin sey I go do.

9And if I sey I go plant or build any nashon or kingdom

10and dat nashon disobey mi and do bad-bad tins, I nor go do wetin I sey I go do.

11So naw, tell Judah and Jerusalem pipol sey, ‘I dey plan and dey ready to ponish dem.’ Tell dem make dem stop to dey sin kon shange di way dem dey live dia life and di tins wey dem dey do.

12But dem go sey, ‘No! Wetin go make us shange? Wi go do anytin wey wi wont! Awa heart strong and wi go do all di wiked tins wey wi wont.’ ”

13God still sey, “Ask di oda nashon if dis kind tin don ever happen before. Israel pipol for bi like woman wey neva ever sleep with man wons, but dem don really do wiked tins.

14Snow dey finish on-top Lebanon rock? Or wota wey dey flow for mountin dey ever stop?

15But my pipol don forget mi, dem dey burn incense give juju and na dis make dem fall komot for di way wey dem suppose follow. Dem nor dey follow di road wey I show dem, instead dem dey follow di road wey nor smooth at-all.

16Naw, di land go turn to where pipol go dey fear and hate. All di pipol wey go pass am, go sopraiz and shake dia head, bikos of wetin dem si.

17I go distroy dem for dia enemies front like san-san wey breeze dey blow kom from east. I go turn my back and I nor go help dem wen di wahala go start.”

18Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”

19So, I kon pray: “My God, make Yu hear and listin to wetin my enemies dey tok about mi.

20Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.

21But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.

22Make tif karry evritin wey dem get for dia house, so dat dem go kry well-well. Bikos dem don dig whole make I fall put kon set trap make e katch mi.

23But my God, Yu know all dia plan to kill mi. Nor forget di wiked tins wey dem dey do and nor forgive dia sin. Make dem die for yor front and make Yu ponish dem as Yu dey vex.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 18.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.