Jeremiah 16pcm

1God tell mi,

2Jeremaya, make yu nor marry or born shidren for dis land.

3Mi wey bi God go tell yu wetin go happen to di shidren wey dem born for dis land with dia papa and mama.

4Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.

5“I tell yu sey, ‘Wen anybody die, make yu nor go visit en family or mourn for am. I nor go love, bless or sorry for Judah pipol again.’

6Rish and poor pipol go die for dis land and nobody go beri or mourn for dem. Pipol nor go kut dia body or shave dia hair to show sey dem dey mourn for dem.

7Nobody go karry food go give doz wey dey mourn or give dem wine drink, bikos dia mama or papa die.

8“Make yu nor go house where pipol for dey do party, tok-less of to follow dem sidan chop and drink.

9Listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok. “Dem nor go hear joy, happiness and marriage nois. Di pipol go dey alive to si all dis tins wen e dey happen.”

10“Wen yu don tell di pipol about all dis tins, dem go ask, ‘Why God won ponish us like dis? Wetin wi do? Wish kind sin wi kommit wey make di Oga awa God dey vex?’

11Den make yu tell dem, ‘God sey, “Na bikos una grand-grand papa rijet mi kon go woship oda gods. Dem forget mi and nor gri obey my law.

12And naw, una sin even worse pass dia own. All of una sturbon, wiked and nor dey obey mi.

13So, I go drive una komot from dis land go where una and una grand-grand papa nor know at-all; land where una go dey woship oda gods both for day time and for nite, bikos I nor go sorry for una.” ’ ”

14God sey, “Time dey kom wen pipol go stop to use mi take swear as di God wey dey alive; wey take Israel pipol komot for Egypt.

15Instead, dem go swear sey, ‘I bi di God wey bring Israel pipol kom out from di land wey dey nort and from all di oda kountries wey I skata dem go.’ Yes! I go bring dem kom back to dia own kountry; di land wey I give dia grand-grand papa. Mi, wey bi God, don tok.”

16“But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.

17Bikos I dey si evritin wey dem dey do; dia wikedness nor hide from mi and e nor get where dem hide dia sin put wey I nor go si am.

18I go make dem pay times two for dia sin and wikedness, bikos dem don dirty my land kon pak dia yeye juju wey nor get life, full am.’ ”

19Den I sey, “My God! Na Yu dey protet and give mi pawa. Yu dey help mi anytime I dey for trobol. Nashons go kom from evriwhere for di eart kon sey, ‘Di gods wey awa grand-grand papa dem get, na only to lie dem know and dem nor fit save anybody.’

20Pipol fit make dia own gods? No! Wetin dem make, nor bi god at-all.”

21Den God sey, “So, I go make dis wiked pipol know my pawa and how I strong rish and dem go know sey na mi bi God.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 16.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.