Jeremiah 15pcm

1Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!

2If dem ask yu, ‘Where wi won go?’ Tell dem sey, ‘God sey: “ ‘ “Pipol wey dem don sey, na diziz go kill, na diziz go really kill dem. Doz wey dem sey go die for war, go really die for war. Doz wey dem sey na honga go kill, na honga go kill dem and doz wey dem sey dem go katch go as slave, dem go katch dem go.” ’

3“ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh

4and I go make all di pipol for di world dey fear, bikos of wetin happen. Dem go fear, bikos of wetin Judah king, Hezekaya wey Manasseh born, do for Jerusalem.” ’ ”

5God sey, “Jerusalem pipol, who go sorry and pity for una? Who go stop kon ask, how una dey?

6Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”

7God still sey, “Just as breeze dey blow and skata dirty for evriwhere, na so too I go skata una for evriwhere for di eart. I go distroy una wey bi my pipol kon kill una shidren, bikos una nor gri stop di bad-bad tins wey una dey do.

8Wimen wey dia husband go die, go plenty pass san-san wey dey near wotaside. I go kill una yong men for aftanoon kon make dia mama sofa. Na mi make dem dey sofa and fear go katch dem well-well.

9Di woman wey bin get seven shidren, go faint. E nor go fit breath well again. Naw wey e suppose to dey enjoy life, dem don take en pride and joy from am. E go bi like sey evening don rish even doh sun still dey shine well-well. Na shame and disgrace go follow am. And any of dem wey still dey alive, I go make dia enemies kill dem for war.” Mi, wey bi God, don tok.

10I kon sey, “Si as I dey vex! Wetin make my mama born mi at-all? Must I kworel and argue with evribody for di land! I neva ever borrow from pesin or borrow pesin money, yet evribody dey curse mi.”

11God ansa, “I go diliver and save Jerusalem from evry attack even doh I allow dia enemies karry dem go, so dat dem go learn. But wen una enemies dey trobol, dem go run kom meet una sey make una help dem.

12Una wey bi like iron and bronze, una fit break di iron wey dey nort?

13I go send enemies kom tif una propaty and dis go bi ponishment for di sins wey una kommit for di land.

14I go make una serve una enemies for strenj land, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”

15Den I ansa, “My God! Yu know as I dey sofa. Abeg make Yu remember kon help mi. Make Yu revensh doz wey dey tok bad against mi. Nor sorry for dem, so dat dem nor go kill mi. Make Yu remember sey na bikos of Yu, dem dey curse mi.

16My Oga God wey dey mighty, anytime Yu dey tok to mi, I dey listin well-well and na joy and happiness full my heart, bikos I bi yor own.

17I nor dey spend my time to play and enjoy mysef with oda pipol. I dey always dey alone; dey obey yor word and I dey vex for evil pipol, bikos of wetin dem don do.

18So, wetin make mi still dey sofa? Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure? Yu dey plan to leave mi like stream wey dry?”

19Bikos of dis, God kon sey, “If yu turn from sin kom meet God kon stop wetin yu dey tok and tink, I go take yu back and yu go bi my savant again. If yu stop to tok anyhow, yu go bi my profet again. Den di pipol go won bi like yu and yu nor go bi like dem.

20Bikos of dem, I go make yu bi like strong wall. Dem go fight yu, but dem nor go fit win. I dey with yu; I go protet and save yu.

21I go save yu from wiked pipol and doz wey like trobol.” Mi, wey bi God, don tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Jeremiah 15.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.