Isaiah 57pcm

1Raitious pipol dey die and nobody undastand or even kare. Betta men dey die, yet nobody dey si di evil wey dey kom.

2Pipol wey dey live betta life, get peace and dem dey rest even wen dem don die.

3But una wey bi sinnas! Make una kom here make dem judge una! Na pipol wey dey do majik and ashawo born una.

4Who una dey fool? Who una dey laf and lie give?

5Una dey woship yeye gods and dey sleep with each oda under doz trees. Una dey sakrifice una shidren for di rock wey dey near di stream.

6Una take smooth stones from der kon dey woship am as god. Una pour wine put kon give dem rice as ofrin. So, una tink sey I dey happy with all dis tins wey una dey do?

7Una dey go di mountins wey high pass go sakrifice and sleep with one anoda.

8Una put una juju for una door-mot and una nor dey respet Mi wey bi God! Una pul una klot, klimb bed with una love wey una give money make dem for sleep with una. Den una kon satisfy unasef.

9Una dey put perfume and oil for body go woship Molek wey una dey koll god. Bikos una dey find gods to woship, una dey send messenjas go far, even go rish where dead body dey.

10Naw, make una si as una dey work hard to find oda gods and yet e nor dey taya una. Una tink sey na bikos una juju dey give una pawa, na-im make una nor dey taya to work?

11God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?

12Una tink sey wetin una dey do dey rite, but I go disgrace una and una juju nor go fit help una.

13Wen una kry for help, make una juju kom save una. Na one small breeze go karry dem go! But pipol wey trust mi go stay di land kon woship mi for my temple forever.”

14God sey, “Klear di road! Klear di road! Make una remove di tins wey fit stop my pipol to turn back kom meet mi!

15Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.

16I give my pipol life and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.

17I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot, so I kon ponish and abandon dem bikos dem sturbon and dey do as dem like.

18I don si how dem dey bihave, but I go heal dem. I go lead and help dem and I go konfort doz wey dey mourn.

19I go give peace to evribody, both doz wey dey far and near! I go heal my pipol.

20But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow; en wave nor dey finish and na so-so dirty e dey bring.

21Wiked pipol nor go ever get peace of mind.” Dis na wetin God tok.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 57.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.