Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Isaiah 56

:
Nigerian - pcm
1 God dey tell en pipol, “Make una do wetin dey good and korrect, bikos I go soon kom save una.
2 I go bless pipol wey always dey keep di Sabat Day and obey di kommand. I go bless doz wey nor dey do wiked tins.”
3 Strenjas wey dey follow una woship, make dem nor sey “God nor go ever take us as en pipol.” And man wey nor fit sleep with woman, make e nor sey, “My own don finish for dis life bikos I nor go ever fit born pikin.”
4 God dey tell dat kind man sey, “If yu honor and keep di Sabat Day; kon do wetin I wont and keep my kovenant,
5 I go remember una name for my temple and among my pipol and dat one betta pass any shidren wey una go fit get and una name go dey forever.”
6 God dey tell di strenjas wey join en pipol, doz wey love and dey serve am well; wey dey keep di Sabat Day and dey faithful as dem dey keep en kovenant sey:
7 “I go bring una kom Zion wey bi my holy hill kon give una joy wen una enter my prayer house, den I go asept di sakrifice wey una go offa for my altar. Dem go koll my temple, ‘Prayer house’, for all di nashons.”
8 God wey get pawa, wey bring Israel en pipol kom back from Babilon, don promise sey E go bring odas kon join dem too.
9 God don tell di oda nashon make dem kom like wiked animals kon skata en pipol.
10 E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!
11 Dem bi like wiked dogs wey nor-tin dey satisfy. Dis leaders nor dey undastand at-all. All of dem dey do as dem like.
12 Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’