Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Isaiah 49

:
Nigerian - pcm
1 Una wey dey stay for far-far land, make una listin to mi! Before dem born mi, God don koll mi. Wen I dey my mama belle, God don already know my name.
2 E make my words sharp like swod and betta arrow wey E fit use anytime kon hide and protet mi with en hand.
3 E tell mi sey, “Israel, yu bi my savant and pipol go praiz mi, bikos of yu.”
4 So I ansa, “I don work well-well, yet my work nor mean anytin! I use all my pawa, but I nor gain anytin.” But I still bilive sey, God go defend and reward mi for evritin wey I don do.
5 And naw, Oga God sey, na mi kreate and form yu from yor mama belle as my savant, so dat yu go bring Jakob, my pipol kom back to mi kon gada Israel togeda. Dis na bikos Oga God don honor mi and na-im bi my strent.
6 God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”
7 God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
8 God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.
9 I go tell doz wey dey prison sey, ‘Make una kom out!’ And doz wey dey for darkness, ‘Make una kom enter lite!’ Dem go bi like sheep wey dey chop grass for hill.
10 Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.
11 I go turn all my mountins to betta road kon prepare road for di hills, so dat my pipol go fit travel pass.
12 Si, my pipol go kom from far; some from nort, west and from Egypt wey dey sout.”
13 So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
14 But Jerusalem pipol sey, “God don abandon us! Di Oga awa God don forget us.”
15 Den God ansa, “E get any woman wey fit forget en own pikin wey e born? But even if mama fit forget dia pikin, I nor go ever forget una.
16 Si, I don rite una names for my hand, una face go always dey my mind.
17 Make una shidren hurry kom. Make doz wey dey distroy, run from una.
18 Make una look round kon si wetin dey happen! Make all una sons gada kom meet una! Naw God dey sey, as long as una shidren dey alive, dem go bi like pomade for una body; una go wear dem like di gown wey woman wey won marry dey wear.
19 Una kountry skata and evribody bin run komot der, but naw, e go dey too small for una pipol. And doz wey leave una wen una dey face wahala, God go remove dem from una forever.
20 Di shidren wey dem born wen una dey sofa, go tell una one day sey, ‘Dis land too small, wi wont more house wey wi go stay!’
21 Den una go tell unasef sey, ‘Who give us all dis shidren? Wi know sey dem kill awa shidren kon karry di rest go as slave. Na only wi dey, so where all dis shidren from kom? Na who born dis shidren? Who train dem for us?’
22 Awa Oga God tell en pipol sey, “Si, I go lift my hand to di nashon kon tell di pipol my laws; dem go karry una shidren kom with dia hand kon put una dotas for dia shoulder.
23 Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
24 So na who go fit seize wetin soja karry kom from war? Una fit go release doz wey strong men katch?
25 But dis na wetin God tok: “True-true, dem go release doz wey dey prison and dem go seize wetin strong men karry kom from war. I go fight with anybody wey fight with una kon save una shidren.
26 I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”