1Awa God sey, “Make yu konfort my pipol! Konfort dem well-well!
2Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.
3One vois dey kry sey, Prepare one road for di wildaness for God! Make una klear di road for di desert for awa God!
4God go raiz-up evry valley and E go level evry mountin and hill. All di bend-bend road go strait and di rof place go smooth.
5Den God glory go kom out and evribody go si am, bikos God don tok am with en own mout.”
6One vois dey kry sey, “Make yu prish one message!” So I ask, “Wish message I go prish?” Di vois ansa, “Make yu prish sey all men na grass; let dem know sey dem nor dey last pass flower wey dey bush.
7Grass dey dry and flowers dey fade wons God send strong breeze go blow dem. Na so too pipol nor dey last pass grass.
8Yes, di grass go dry and flower go fade, but awa Oga God word go dey forever.”
9So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!
10God wey dey mighty dey kom rule with pawa and E dey bring di pipol wey E don save with am.
11E go kare for en animals just as shepad dey do. E go gada di lamb togeda kon karry dem for en hand; E go lead and guide dem.
12E get anybody wey fit pak wota for hand kon measure am? Abi who fit measure di sky? Abi anybody don fit weigh all di san for di eart or weigh di mountins and hills with skale?
13E get anybody wey fit tell or tish God wetin E go do? Abi pesin dey wey go advise God?
14Who God dey go ask make E for fit undastand how E go do tins?
15Si, di nashons nor mean anytin to God, dem bi like one drop of wota. Di island wey dey for far nor heavy rish dust for God hand.
16All di animals wey dey for Lebanon forest nor rish to take offa sakrifice for God and all di trees nor plenty rish to take make fire for di sakrifice.
17All di nashons nor mean anytin to am at-all. For God eye, dem nor mean anytin at-all.
18Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?
19E nor bi like juju wey man make or di one wey doz wey dey karve wood kover with gold or put silva.
20Pesin wey nor fit buy silva or gold go use wood wey nor go rust and e go find who sabi di work make e help am make image wey nor go skata.
21Una nor know? Dem neva tell una since? Una neva hear how di world take start?
22Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.
23Na-im dey make rulers rule with pawa kon still bring dem down.
24Dem bi like yong plants wey just dey grow kom out wey pipol rut trowey. Wen God send en breeze kom, di flower dey dry and blow komot like grass.
25Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?
26Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si? Na-im dey lead dem like sojas. E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name! En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.
27So, Israel pipol! Why una dey komplain sey God nor know una trobols or kare if una dey sofa at-all?
28Una nor know? Una neva hear? God go dey forever. Na-im kreate di whole world. E nor dey taya or weak. Nobody fit undastand wetin E dey tink.
29E dey give strent and pawa to pipol wey dey weak.
30Even yong pipol go taya and strong yong men go kwik too.
31But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.