Isaiah 27pcm

1For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.

2Wen di time rish, make una sing about God vineyard!

3“Na mi wey bi God go protet am, I dey always look and wota am. I dey guide am both for day and nite, so dat nobody go skata am.

4I nor dey vex for di vineyard again. If enemies won attack my pipol, I go mash go fight and burn dem with fire.

5But if my pipol enemies wont make I protet dem, make dem make peace with mi. Yes! Make dem make peace with mi.”

6Time dey kom wen Jakob shidren-shidren go get rut like tree and dem go grow well. Di fruit wey dem go bear, go full di eart.

7God don distroy Israel pipol, just as E do doz wey dey opress dem? E don kill Israel pipol as E kill dia enemies?

8No, but God vex for en pipol kon send dem go Babilon as dia ponishment. E karry dem komot from dia land with one strong breeze from di east.

9So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.

10Naw, dem don distroy all di strong towns. E empty and e don turn desert where animals for dey kom look for food chop.

11Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.

12Di time dey kom wen God go shake di tree from Eufrates River go rish di rut for Egypt and just as farmer dey separate korn from dia kanda, na so too God go gada and separate en pipol one-by-one.

13Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 27.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.