Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Isaiah 24

:
Nigerian - pcm
1 Si, awa Oga God dey ready to skata di world kon turn am to where dem dey trow dirty put. E go shake di world kon skata evribody wey dey stay inside.
2 Evribody go sofa; priests and pipol; slaves and dia oga dem; pipol wey dey buy and sell; pipol wey dey borrow odas money and doz wey dey borrow from dem; plus rish and poor pipol: all of dem go sofa di same tin.
3 Di world go skata finish and nor-tin go remain. God don tok and na so e go bi.
4 Di eart don dry, di whole world dey shake like pesin wey kold dey katch and e don dry too; pipol wey dey popula for dis world, don die go.
5 Di pipol wey dey dis world, don skata am with sin, bikos dem nor gri obey God law or keep en kovenant wey go last forever.
6 So, God don curse di world. Pipol dey pay for wetin dem do and dis na why dem dey die anyhow and na only few of dem remain for di world.
7 Di new grape vine don dry and wine nor dey again. All di pipol wey dey happy before, don dey vex naw
8 and dem nor dey play dia drums, harps or sing and happy again.
9 Dem nor dey sing or drink wine again, bikos nobody dey enjoy di taste bikos e dey bitter naw.
10 Di whole town don skata and pipol lock diasef inside dia house, so dat dem go dey save.
11 Dem dey shaut for dia street, bikos of wetin happen to dia wine. Happiness don komot di land forever and na sorrow full der naw.
12 Di town don skata and en gate don fall for groun.
13 Dis na wetin go happen for evriwhere for di world. E go bi like wen dem dey plok olive tree fruit for harvest time kon leave only di small-small wons for der.
14 Di pipol wey go survive go sing with happiness; doz wey dey for west go tok how God big and great rish
15 and doz wey dey for east, go praiz am. Di pipol wey dey stay near sea go praiz di Oga wey bi Israel pipol God.
16 Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem dey praiz Israel pipol God wey dey raitious. But I nor get hope at-all and na die I dey die go so, bikos pipol wey dey lie, still dey lie and doz wey dey deceive odas, still dey deceive!
17 So make evribody listin to mi! Wahala, big pit and trap wey dem set dey wait to katch and kill all di pipol for dis eart.
18 Anybody wey run from di wahala go fall for di pit and anybody wey won eskape from di pit, di trap go katch am, bikos wahala like heavy rain go fall from heaven and di eart foundashon go shake.
19 Di world don break to pieces; e don krack open kon dey shake well-well.
20 Di world go stagga like drunkard man; e go shake like house wey heavy rain dey disturb. En sin go draw am fall for groun; e go fall and e nor go raiz-up again.
21 For dat time, God go ponish di wiked spirits wey dey di sky with doz wey dey rule as kings for dis world.
22 God go gada dem put for pit, lock dem for prison and afta dem don stay der tey, E go kon ponish dem.
23 Di moon go dey dark and sun nor go shine again, bikos Oga God wey dey lead heaven sojas, go rule from Mount Zion for Jerusalem and evribody go si en glory wey big well-well.