Isaiah 1pcm

1Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.

2Heaven and eart, make una listin to wetin God tok: “Di shidren wey I train by mysef don turn against mi.

3Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”

4Una own don finish like who don die, bikos una pipol dey kommit sin. Una don spoil finish and dey do evil tins! Una sins dey bring una down, bikos una don rijet di Holy Pesin, wey bi Israel God kon turn against am.

5Israel pipol, wetin make una still wont make dem beat una? Una wont make dem ponish una pass dis ones? Sore don already full una head and una body don rotin finish.

6From una head go rish una leg, na sore full am. Una body don skata, bikos sore full evriwhere and dem nor bandage, klean or trit dem at-all.

7Una land don skata and fire don burn una towns finish. For una front, strenjas dey distroy una plants kon skata evritin wey dem si.

8Na only Jerusalem remain and e bi like one small house wey dem build for farm or for cucumber field.

9If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.

10So Sodom leaders, make una listin to wetin God dey tell una. Gomorrah pipol, make una put ear for wetin God dey tish una.

11E sey, “Una sakrifice nor mean anytin to mi. I don taya for una animal ofrin; I nor like una goats, bull or melu blood.

12Who sey make una dey bring dis animals wen una dey kom woship mi? Who sey make una dey mash round my temple?

13Make una stop to bring una yuzles ofrins bikos di smell of di incense wey una dey burn, dey make mi vex. I nor wont una new moon festival; una Sabat and where una for dey gada woship mi, bikos sin don spoil all of dem.

14I hate una new moon festival and di oda feast wey una dey celebrate, don taya mi. I nor fit bear dem again.

15Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.

16Make una go wosh unasef klean and stop all di evil tins wey una dey do.

17Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”

18Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.

19If una obey mi, una go chop di good food wey di land dey produce.

20But if una sin against mi, una go die. Mi, wey bi God, don tok.”

21Di town wey dey faithful before, don dey do like ashawo! Na only holy men dey inside before, but naw, na doz wey dey kill pipol, remain.

22Jerusalem pipol, before-before, una bi like silva, but naw, una don dey yuzles. Una bi like good wine before, but naw, una bi like ordinary wota.

23Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.

24Naw, make una listin to wetin Israel God wey get pawa, dey tok, “I go fight against my enemies kon pay dem back for wetin dem do.

25I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.

26I go give una betta rulers with doz wey go advise una well just like di ones wey una get before. Den pipol go koll Jerusalem holy and faithful town.”

27Bikos God dey holy, E go save Jerusalem and anybody wey turn from sin kom meet am.

28But E go kill anybody wey dey sin and fight against am. E go kill anybody wey nor respet am.

29Una go shame for unasef, bikos una woship trees kon build some juju gardin.

30Una go fade like oak tree wey dey die; like gardin wey nobody pour wota put.

31Just as dem dey distroy grass with fire, na so dem go distroy men wey get pawa bikos of di evil wey dem do and nobody go fit stop di distroshon.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Isaiah 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.