Ezekiel 24pcm

1Nine years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di tent mont, God kon tell mi sey:

2“Man pikin, make yu rite today date for groun, bikos Babilon king go seize Jerusalem.

3Make yu go tell my sturbon pipol dis parabol wey mi, God get for dem: “Make una put di pot for fire kon pour wota full am.

4Put di betta part for di meat inside: di shoulder, di legs and di difren parts.

5Na di sheep wey fine pass, una go kook. Make una pak wood under di pot make di wota for kwik boil; den una go boil di bone and di meat well-well.”

6Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Di town where dem for dey kill pipol, curse dey una head! E bi like dirty pot wey dem nor fit wosh klean. Dem dey remove di meat one-by-one and nor-tin remain inside.

7Di pipol wey e kill, na dia blood dey di town. Di pipol blood nor tosh groun where san go for fit kover am. Instead, di blood stain di rock.

8I don leave di blood for der; di place where dem nor go for fit hide am and e dey make mi vex more-more as e dey kry for revensh.”

9Dis na wetin God wey get pawa dey tok, “Di town where dem for dey kill pipol, curse dey una head! Na mi go gada di wood by mysef.

10So make una still bring wood kom! Blow di fire! Kook di meat! Boil am well-well. Yes! Make dem burn di bones finish.

11Naw, put di empty pot on-top di shako, den leave am make e red well-well. Den di pot go dey klean again afta fire don burn di yeye tins wey dey inside komot.

12But all dis yeye tins nor go vanish komot like dat.

13Jerusalem pipol! Una yeye life don make una dirty, even doh I try make una dey klean, una still dirty. Una nor go dey klean again until my vexnashon don fall on-top una with full force.

14“Mi God don tok. Di time don rish for mi to do wetin I won do. I nor go let una sin finish kon go like dat or sorry for una. I go ponish una for wetin una don do.” God wey get pawa don tok.

15God tell mi.

16“Man pikin, na one blow I go take kill di pesin wey yu love pass. Make yu nor tok or kry.

17Nor let pipol hear yu kry. Nor skrape yu head or waka with ordinary leg like sey yu dey mourn. Nor kover yor face or chop di kind food wey pipol wey dey mourn dey chop.”

18So for early morning, I tok to di pipol. But my wife die for evening and di next day I kon do as God tell mi.

19Pipol kon dey ask mi, “Wetin make yu dey bihave like dis?”

20I ansa dem, “God sey make

21I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’

22Den una go do wetin I don do so. Una nor go kover una face or chop food wey pipol wey dey mourn dey chop.

23Una nor go skrape una head or waka with ordinary leg like pipol wey dey mourn. Bikos of una sins, una go die anyhow kon dey komplain give each oda.

24Ezekiel go bi ezample to una; una go do evritin wey I don do. God sey wen all dis tins happen, una go know sey na-im bi Oga God.”

25God kon sey, “Man pikin, I go remove di strong temple wey bi dia joy and pride. Di temple wey dem dey like to look and visit. I go still take dia shidren komot dia hand.

26For di day wey I go do wetin I tell yu so, pesin wey go eskape di wahala go kom tell yu di news.

27Dat same day, yor mout go open and yu go fit tok again. Yu go tok to di pesin wey eskape kom and dis go bi sign to di pipol, den dem go know sey na mi bi God.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Ezekiel 24.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.