1God tell mi:
2“Man pikin, e get two sistas like dat.
3Wen dem dey yong for Egypt, dem kon stay to do ashawo.
4Di senior one name na Oholah (wey bi Samaria) while di yonga one na Oholibah (wey bi Jerusalem). I marry dem two and dem born shidren for mi.
5Even doh e bi my wife, Oholah still dey do ashawo and e dey run follow Assyria sojas
6wey wear purpol uniform; pipol wey dem dey respet, honor and wey fine well-well.
7Na Oholah all di ofisas for Assyria dey sleep with, so e kon dirty ensef as e dey woship Assyria juju.
8E still dey do ashawo and na from Egypt e for start to sleep with difren pipol. Na since e yong, men don dey sleep with am and dem dey trit am like ashawo.
9So I kon gi-am to Assyria pipol wey e love well-well.
10Dem naked am kon take en shidren komot en hand, den dem kill-am with dia swod. E kon turn who nor get shidren again and dem dey ponish am for evriwhere for di world.
11Even doh en sista Oholibah si wetin happen, en own ashawo kon strong well-well pass Oholah own.
12En too love Assyria ofisas; di sojas wey wear fine uniform and e even love di main ofisas and all di men wey fine.
13I si sey e bad well-well. Dat is, di sekond sista kon dey do like di first one.
14Dis one ashawo kon worse well-well. E even won sleep with di ofisas image wey dem karve for wall wey bi; Kaldea image wey dem karve; paint with red
15kon tie belt for en waist with fine priest kap for en head.
16As e just si dia image, e love dem kon send messenjas go meet and koll dem kom from Babilon.
17Babilon pipol kom sleep with am. Dem use am anyhow kon make am dirty sotey e kon taya for dem.
18E naked kom out kon let evribody know sey e bi ashawo. I vex for am, just as I vex for en sista.
19En own ashawo dey worse evriday; e dey do tins wey e dey do since wen e start ashawo work for Egypt.
20Just like donkey or horse, na so too e nor dey fit kontrol ensef wons e si man wey fine well-well.
21Oholibah, yu won still do di ashawo wey yu do for Egypt wen yu bi small girl? Where men for dey play with yor breast and sleep with yu.
22“Naw, Oholibah, dis na wetin God wey get pawa dey tell yu. Yu don taya for yor lovers, but I go make dem vex and gada round yu.
23All di men for Babilon and Kaldea, I go bring dem kom from Pekod, Shoa, Koa and Assyria. I go gada doz fine men togeda.
24Dem go attack yu from nort with many sojas and shariot. Dem wear shield and helmet for head and dem go gada round yu. I go give yu to dem and dem go judge yu with dia own law.
25Bikos I dey vex for yu, I go let dem ponish yu as dem dey vex. Dem go kut yor nose and ear komot and dem go kill yor shidren. Yes! Dem go take yor shidren from yor hand kon burn dem alive.
26Dem go tear yor klot kon take all yor gold.
27I go stop yor yeye life and all di nonsense wey yu don do since wen yu bi small girl for Egypt. Yu nor go look anytin wey bi like juju again or tink about Egypt.”
28Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go give yu to pipol wey yu hate well-well.
29Bikos dem hate yu, dem go take evritin wey yu don work for and yu nor go get anytin again; yu go dey naked like ashawo. Na yor yeye and ashawo life
30make all dis tins dey happen to yu. Yu bi dia ashawo and yu don spoil yor body with dia juju.
31Yu dey do as yor sista dey do and I go give yu dis ponishment cup wey I give yor sista make e drink from.”
32God wey get pawa sey, “Yu go drink from yor sista cup; e dey big and deep. Evribody go laf yu well-well, bikos yor cup don full.
33Di cup go make life taya yu and yu go bi like man wey don drink well-well. Dis cup get fear; wahala full am and na yor sista, Samaria, get am.
34Yu go drink am dry, break am to pieces kon use am take tear yor breast.” Mi, God wey get pawa, don tok.
35Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Bikos yu forget and turn from mi, yu go sofa for yor ashawo life.”
36God tell mi, “Man pikin, yu dey ready to judge Oholah and Oholibah? Judge dem for di yeye life wey dem live.
37Dem sleep with pipol husband kon kill many pipol. Dem sleep with juju kon kill di boys wey dem born for mi. Dem sakrifice my shidren give juju.
38Since dat one nor rish dem, dem dirty my temple kon skata di Sabat wey I make holy.
39Di day wey dem sakrifice my shidren give juju, na dat day dem still dirty my temple!
40Evritime, dem go send pipol go invite men kom from far. Di two sistas go baf kon take difren tins with gold take design dia face.
41Dem go sidan for betta chair and for dia front, fine-fine tins like incense and olive oil wey I give dem, dey di tabol.
42Pipol wey nor kare dey der dey shaut and na wildaness dem from bring dis pipol. Dem put shain for di wimen hand kon wear betta crown for dia head.
43Den I tok about dis ashawo woman sey, ‘Dem go sleep with am naw.’
44Dem dey sleep with am just as dem dey sleep with ashawo. Like dis, dem don sleep with Oholah and Oholibah wey bi ashawo.
45Pipol wey dey do good go ponish dem, bikos dem kill and sleep with pipol and di pipol blood dey dia hand.”
46So, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Make yu bring pipol wey go give dem wahala and tif from dem.
47Make dem stone and attack dem with swods; kill dia shidren kon burn dia house rish groun.
48I go stop all dis yeye life for dis land and e go bi warnin to wimen sey, make dem nor sleep with who nor bi dia husband, bikos dis na wetin dem dey do.
49But for dis two sistas; I go ponish dem for dia ashawo life and di juju wey dem dey serve. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”