Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Ecclesiastes 10

:
Nigerian - pcm
1 Just as fly wey don die dey make perfume smell, na so too small foolishness dey spoil pesin wisdom and respet.
2 Wise man sense dey protet am, but di sense wey fools get, dey put dem for wahala
3 and even wen foolish pesin dey waka for road, e dey know and show evribody sey e bi fool!
4 If yor oga dey vex for yu, make yu nor vex stop di work wey yu dey do, bikos gentol spirit dey korrect big mistake.
5 E get anoda bad tin wey I don si for dis world and na big mistake wey kings dey make,
6 bikos dem go give betta pozishon to fools kon put wise pipol for di yeye ones.
7 I don even si where savant dey ride horse like sey e bi prince, while prince dey waka like sey e bi savant!
8 Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.
9 Anybody wey dey work for where dem dey kut stones, di stones fit fall press am. If yu dey kut wood, di axe fit still wound yu too.
10 Yu go nid to use more pawa take kut wood if di axe wey yu dey use nor sharp, so make yu sharp di axe well. Dis na di value wey dey wisdom and e go help yu susid.
11 If snake bite pesin before dem sharm am, den e nor get nid to koll di pesin wey dey sharm snake.
12 Wise pesin word dey favor am, but fool own, dey distroy am,
13 and na only yeye tins fools dey tok and na madness dey end am,
14 bikos dem go just dey tok anyhow waka. So, nobody really know wetin go happen naw or di ones wey go happen for future.
15 Foolish pesin work dey kwik taya am, bikos e nor even know road to follow go en house.
16 E go bad for any town wey dia king dey tink like small pikin and dia leaders dey always do party till day break.
17 Kountry wey en king get betta karata, wey en leaders dey chop for di rite time, so dat dem go get pawa and nor dey drink anyhow, na blessing go follow dem.
18 Na so too, wen pesin too lazy to ripair en house, wen en zink dey leak, di house go fall.
19 Party na to make pesin happy and to dey drink wine dey bring joy, but na money dey ansa evritin!
20 Make yu nor curse di king for yor mind or curse rish pipol for yor room, bikos one small bird fit karry wetin yu dey tok and tink, go tell dem.