1Some profet kon tell Elisha “Si, di place where wi dey stay too small for us.
2So make wi go Jordan aria where wi go for get and kut betta wood kon build betta house for awasef for der.” Elisha ansa dem, “Make una go.”
3But one of dem tell am, “Abeg oga, make yu follow us go.” So Elisha ansa, “Okay, I go follow una.”
4So e follow dem go. Wen dem rish Jordan, dem kon start to kut trees down.
5As dem dey kut, one of dem axe head kon fall enter Jordan river. Den e shaut, “My oga, I don die. Na borrow I borrow dis axe o-o!”
6So Elisha ask, “Na wish side e fall put?” So di man show am where e fall put, den Elisha kut small branches for di tree kon drop am put for der, den di axe head kon float kom up.
7Elisha tell di man, “Make yu pick di axe komot from di wota.” So di man kon pick am.
8Naw, Siria pipol kon dey fight Israel pipol. Siria king kon koll doz wey dey advise am and dem tell am where and wen e go take attack.
9But Elisha sey make dem go tell Israel king sey, “Make yu nor pass thru dis place, bikos Siria king go attack der.”
10So Israel king send message go meet en men about wetin Elisha tok and e warn dem well-well. Nor bi only wons dis tin happen.
11Di tin kon make Siria king dey vex well-well. So e koll all doz wey dey advise am kon sey, “E bi like sey one of us dey help Israel king.”
12One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”
13So di king sey, “Make una go find out where e dey, so dat I go send men go katch am kom.” Leta, dem kon tell di king, “Elisha dey for Dotan.”
14So e send strong sojas and horse make dem go katch Elisha kom. Dem rish der for nite kon surround di town.
15Wen Elisha savant get up for early morning go outside, e kon si sey sojas surround di town with dia horse. Den e go tell Elisha, “Oga! Na die wi dey so o-o, wetin wi go do naw?”
16Elisha ansa, “Make yu nor fear, bikos di ones wey dey with us, many pass di ones wey dey with dem.”
17Den Elisha kon pray, “Oga God, make Yu open my savant eye, so dat e go si for ensef.” So God open di savant eye, so e kon si sey many horse with fire kover di mountins wey surround Elisha.
18As Siria sojas dey kom, Elisha kon pray, “Oga God, make yu blind all dis pipol eye.” So God make dem blind, just as Elisha ask.
19Den Elisha tell dem, “Dis nor bi di rite road or town. Make una follow mi and I go take una go meet di man wey una dey find.” So e karry all of dem go Samaria.
20Wen dem don enter Samaria, Elisha kon sey, “My Oga God, make Yu open dia eye, so dat dem go si.” So God open dia eye and dem kon si sey dem dey inside Samaria.
21Wen Israel king si dem, e kon ask Elisha, “My oga, make I kill all of dem?”
22Elisha ansa, “Nor kill dem! Yu nor katch dem with yor swod or arrow, so who give yu di pawa to kill dem? Make yu give dem food chop and wota drink, den make dem go back go meet dia oga.”
23So di king do big party for dem and dem chop and drink. Den e send dem go back go meet dia oga. Afta dat, no soja for Siria ever kom fight against Israel pipol again.
24Leta, King Ben-Hadad for Siria gada all en sojas go surround and attack Samaria.
25Bikos of wetin dey happen so, Samaria pipol food kon finish and dem kon dey sell donkey head for eight silva and half pound for dove shit kon bi five silva.
26As Israel king dey strol pass di town wall, one woman kon shaut, “My king, make yu help us o-o!”
27Di king ansa, “No! If God nor help una, na how I won take help una? I fit give una korn wen korn nor dey? Abi I fit give una wine wey I nor get?”
28Den di king ask di woman, “Wetin bi yor problem?” Di woman ansa, “One woman sey, ‘Make yu give mi yor pikin make wi chop today, den wi go chop my own tumoro.’
29So wi boil my pikin chop. Di next day, I kon tell am, ‘Bring yor pikin make wi chop,’ but e nor gri!”
30Wen di king hear wetin di woman tok, e tear en klot. As di king dey waka pass di town wall, di pipol kon si sey e wear sak klot.
31Den di king sey, “Make God ponish mi if I nor kut Shafat pikin, Elisha head komot before today go end!”
32By dis time, Elisha sidan for en house with di kommunity leaders. Di king kon send pesin go for front, but before e rish der, Elisha tell di leaders, “Una nor know sey di pesin wey di king send dey kom kut my head komot? So, wen e rish here, make una lock di door, so dat e nor go enter, bikos en oga dey kom for back.”
33E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”