2 Kings 21pcm

1Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-five years. En mama name na Hepzibah.

2E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der.

3E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.

4E build juju altar for God Temple, even wen God don sey, “Jerusalem na my house.”

5For di two kourtyard wey dey God Temple, e build altar for all di stars wey dey di sky.

6E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.

7E put Asherah juju wey e make for di temple, di place where God don tell David and en pikin, Solomon sey, “Dis temple for Jerusalem wey I don choose from all di tribes for Israel, go bi where I go stay forever.

8I nor go porshu Israel pipol from dis land wey I don give to dia grand-grand papa, as long as dem obey all di kommand and laws wey I give dem thru Moses, my savant.”

9But dem nor gri obey and Manasseh make all of dem bigin sin pass di kountries wey God distroy bikos of Israel pipol.

10So God kon tok thru en savant di profet sey:

11“King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju.

12So dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok, ‘I go kause wahala for Jerusalem and Judah pipol. And e go shok anybody wey go hear wetin happen.

13As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean.

14Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty,

15bikos dem don sin against mi kon make mi dey vex since wen dia grand-grand papa komot from Egypt kon rish naw!’ ”

16Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.

17Di remainin tins wey Manasseh do, plus all wetin e get and di sins wey e kommit, dem rite dem put for Judah kings history book.

18Manasseh die and dem beri am for Uzza gardin wey dey en palis and en pikin, Amon kon take-ova as king.

19Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for two years. En mama name na Meshullemet and na Haruz wey kom from Jotbah, born di woman.

20E nor gri obey God kommand, but e sin like en papa Manasseh.

21E dey do like en papa, bikos en too dey woship and bow to yeye gods and juju wey en papa woship.

22E nor gri follow en grand-grand papa dem Oga wey bi God or listin to en kommand.

23Amon savants kon plan and kill-am for en palis.

24Di pipol for di land kon kill all doz wey plan kill King Amon, den dem kon make en pikin Josaya, king for Judah.

25Di remainin tins wey Amon do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book.

26Dem beri am for en own grave for Uzza gardin and en pikin Josaya kon take-ova as king.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Kings 21.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.