2 Kings 15pcm

1For twenty-seven years wen Jeroboam dey rule Israel, Amazaya pikin, Zabud kon bi king for Judah.

2E bi sixteen years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-two years. En mama na Jekolaya wey kom from Jerusalem.

3E do evritin wey God kommand am, just as en papa Amazaya obey God too.

4But e nor skata di juju place, so dem still dey go offa sakrifice and burn incense for der.

5God kon make di king sick. Di king get diziz for en skin until di day wey e die. Only en kon dey stay for one house, while en pikin Jotam dey kare, handle di palis and rule di pipol.

6Di remainin tins wey Zabud do, plus all wetin e get, dem rite am for Judah kings history book.

7Zabud die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Jotam kon take-ova as king.

8For thirty-eight years wen King Zabud dey rule Judah, Jeroboam pikin, Zekaraya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for six mont.

9E nor gri obey God, just as en grand-grand papa dem do. E kontinue to do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.

10Jabesh pikin, Shallum kon plan and kill-am for Ibleam, den take-ova as king.

11Di remainin tins wey Zekaraya do, dem rite am for Israel kings history book.

12Di way wey dem take kill-am kon make wetin God tok happen wen E tell Jehu sey, “Na four generashon for yor shidren go rule Israel.” And dat na wetin happen.

13For thirty-nine years wey Uzzaya bi king for Judah, Jabesh pikin, Shallum kon bi king for Israel. E rule from Samaria for one mont.

14Gadi pikin, Menahem kon from Tirzah go attack King Shallum for Samaria. E kill-am kon take-ova as king.

15Di remainin tins wey Shallum do, plus all en plans, dem rite dem put for Israel kings history book.

16For dat time, Menahem from Tirzah attack Tifsah. E kill evribody wey dey di town and doz wey dey stay near di town, bikos dem nor gri surenda. Even wimen wey get belle for der, e kut dia belle open.

17For thirty-nine years wey Zabud bi king for Judah, Gadi pikin, Menahem kon bi king for Israel. E rule from Samaria for twelf years.

18E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin. Wen e dey rule,

19Assyria king, Pul kon attack di land and Menahem kon gi-am 1,000 silva, so dat di king go support and help am kontrol di kingdom.

20Menahem kollect di silva from di rish pipol wey dey Israel. E take fifty-fifty silva from all of dem kon gi-am to Assyria king. Den Assyria king komot dia land and e nor kom back again.

21Di remainin tins wey Menahem do, plus all wetin e get, dem rite am put for Israel kings history book.

22Menahem die and en pikin, Pekahaya kon take-ova as king.

23For fifty years wen King Zabud dey rule for Judah, Menahem pikin, Pekahaya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for two years.

24E nor gri obey God kommand; e kontinue to do like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.

25En offisa Pekah wey bi Remalaya pikin plan against am. En and fifty men from Gilead kon kill King Pekahaya, Argob and Arieh for Samaria. Dem kill dem for di place wey dem dey guide pass for di palis. Pekah kon take-ova as king.

26Di remainin tins wey Pekahaya do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book.

27For fifty-two years wey King Zabud dey rule Judah, Remalaya pikin, Pekah kon bi king for Israel.

28E nor gri obey God; e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.

29Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.

30For twenty years wey Uzzaya pikin, Jotam don dey rule for Judah, Elah pikin, Hoshea kon plan and kill King Pekah wey Remalaya born, den e take-ova as king.

31Di remainin tins wey Pekah do, plus all wetin e get, dem rite am put for Israel kings history book.

32For di sekond year wey Remalaya pikin, King Pekah dey rule Israel, Uzzaya pikin, Jotam kon bi king for Judah.

33E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for sixteen years. En mama na Jerusha wey bi Zadok pikin.

34Just like en papa Uzzaya, en too do as God kommand am.

35But e nor skata di juju place, so di pipol still dey go der go offa sakrifice and burn incense. E build di Uppa Gate for God Temple.

36Di remainin tins wey Jotam do, plus all wetin e get, dem rite dem put for Judah kings history book.

37For dat time, God kon make King Rezin for Siria and Remalaya pikin, Pekah attack Judah.

38Jotam die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Ahaz kon take-ova as king.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Kings 15.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.