1For di sekond year wen Jehoahaz pikin, King Joash dey rule Israel, Joash pikin, Amazaya kon bi king for Judah.
2E bi twenty-nine years wen e start to rule from Jerusalem. Na Jehoaddin wey kom from Jerusalem bi en mama.
3E do wetin God kommand, but nor bi as en grand-grand papa David do. E follow en papa Joash, ezample.
4But e nor distroy di place where di pipol for still dey offa sakrifice and burn ofrin give juju.
5Afta e don bi king, e kill di savant wey kill en papa.
6But e nor kill di savant shidren. E obey God kommand, just as dem rite for Moses Law sey, “Make una nor kill papa, bikos of wetin dia pikin do and make una nor kill pikin, bikos of wetin dia papa do. If una must kill anybody, make e bi for en own sin.”
7E win 10,000 Edom sojas for Salt Valley, katch Sela for war kon gi-am anoda name wey bi “Jokteel” and na dis name dem dey koll am kon rish today.
8Dem send Amazaya go meet King Jehoash wey bi Jehoahaz pikin and Jehu grand-pikin for Israel sey, “Make yu kom make wi si face-to-face.”
9King Jehoash ansa King Amazaya, “Lebanon bush send message to di cedar for Lebanon sey, ‘Make yu give yor dota to my son as en wife.’ Den one wiked animal for Lebanon kon skata di bush.
10Yu distroy Edom pipol and e don dey make yor head big! Yu dey happy bikos yu win, but make yu stay for yor palis. Wetin make yu dey kause wahala for yorsef? Wetin make yu won distroy yorsef and Judah?”
11But King Amazaya nor gri listin to am, so King Jehoash for Israel kon attack am. King Jehoash and Amazaya kon meet one-on-one for Bet-Shemesh wey dey Judah.
12Israel pipol win Judah pipol and all of dem run go back to dia house.
13Na Bet-Shemesh, Israel king, Jehoash for katch King Amazaya wey bi Jehoash pikin and Ahazaya grand-pikin. E attack Jerusalem kon break di wall from Efraim go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.
14All di gold, silva, di tins for God temple, di palis and evry oda tins wey dem seize from war, e kon karry dem go back to Samaria.
15Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get and en viktory ova King Amazaya for Judah, dem rite am for Israel kings history book.
16Jehoash die and Jeroboam kon take-ova as king. Dem beri am with Israel kings for Samaria.
17Joash pikin, King Amazaya for Judah, stay for anoda fifteen years afta, Jehoahaz pikin, King Jehoash for Israel don die.
18Di rest tins wey Amazaya do, dem rite am for Judah kings history book.
19Dem plan against am for Jerusalem, so e run go Lakish. But dem send some men go find and kill-am for der.
20Dem karry en dead body put for horse kon beri am for Jerusalem with en grand-grand papa dem for David Town.
21So Judah pipol take Zabud, Amazaya pikin wey bi sixteen years kon crown am as dia king.
22Afta di king don die, Zabud kon ribuild Elat for Judah.
23For di Fifteent year wen Joash pikin, King Amazaya dey rule Judah, Joash pikin, Jeroboam kon bi king for Israel and e rule from Samaria for forty-one years.
24E nor gri obey God kommand; instead e kontinue to dey do bad tins like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
25E bring Israel borda kom back from Lebo-Hamat for nort go rish Arabah wotaside for sout, just as di Oga, Israel God tok thru Profet Jonah wey en papa bi Amittai, wey bi profet for Gat-Hefa.
26God si as Israel pipol dey sofa; di sofa strong well-well, bikos nobody dey to help dem, weda slave or free man.
27Bikos God nor won skata Israel pipol kom from di eart, E kon save dem thru Joash pikin, Jeroboam.
28Di remainin tins wey Jeroboam do, plus all wetin e get and en viktory wey make Israel take-ova Damaskus and Hamat, dem rite all for Israel kings history book.
29Jeroboam die and en pikin Zekaraya kon take-ova as king. Dem beri am with Israel kings for Samaria.