2 Kings 1pcm

1Afta Ahab don die, Moab pipol kon go fight Israel pipol.

2For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”

3But God angel tell Profet Elijah wey kom from Tishbe, “Get up! Go meet di messenjas wey Samaria king send kon tell dem, ‘Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God?

4So make una hear wetin God dey tell di king: “Yu nor go stand up from di bed wey yu dey so, bikos yu must die!” ’ ” So Elijah kon go.

5Wen di messenjas go back, di king kon ask dem, “Wetin make una kwik kom back like dis?”

6Dem ansa, “One man tell us, ‘Make una go back go tell di king sey, “Dis na wetin God tok: Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God? So di king nor go stand up from di bed wey e dey so, bikos e go die.” ’ ”

7Di king kon ask dem, “Make una diskribe di man wey tell una all dis tin.”

8Dem ansa, “E get hair full en body kon tie leda belt for waist.” Di king kon sey, “Dat na Elijah wey kom from Tishbe.”

9Den di king send one offisa with fifty sojas make dem go arrest Elijah kom. Dem go meet Elijah for where e sidan on-top hill kon tell am, “Profet! Di king sey make yu follow us kom!”

10Elijah ansa di soja oga, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down, burn all of dem.

11Di king send anoda offisa and fifty sojas go again. Di offisa tell Elijah sey, “Profet! Di king sey make yu follow us kom.”

12Den Elijah ansa, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down kon burn all of dem.

13Di king still send anoda offisa and fifty sojas go. Dis third offisa go meet Elijah kon fall for en front dey beg am, “Profet! Abeg, make yu nor kill mi and my men wey bi yor savants.

14True-true, wi know sey, fire kom down from heaven kon kill di two ofisas with dia men wey first kom. So wi dey beg make yu nor kill us.”

15So God angel tell Elijah, “Make yu follow am go meet di king. Make fear nor katch yu at-all.” So Elijah stand up kon follow am go meet di king.

16Elijah tell di king, “Dis na wetin God tok, ‘Wetin make yu send pipol go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos yu tink sey Israel pipol nor get God wey yu fit ask? Bikos of dis, yu nor go stand from di bed wey yu dey so and yu must die.’ ”

17Di king die just as God tok thru Elijah. For di sekond year wey Jehoshafat pikin, Jehoram bi king for Judah, Ahazaya broda wey bi Jehoram kon bi king for Israel, bikos di former king nor born boy at-all.

18Di remainin tins wey King Ahazaya do, dem rite dem put for Israel kings history book.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Kings 1.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.