1 Kings 22pcm

1Peace kon dey between Israel and Siria for two years,

2but for di third year, King Jehoshafat for Judah go si King Ahab for Israel.

3King Ahab ask en ofisas, “Since na wi get Ramot for Gilead, wetin make us neva try to kollect am back from Siria king?”

4So King Ahab ask King Jehoshafat, “Yu go follow mi go attack Ramot for Gilead?” Jehoshafat ansa, “Mi and my sojas dey ready, if yu ready.

5But make wi ask God first.”

6So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”

7But King Jehoshafat ask, “E nor get anoda profet wey wi fit still ask?”

8King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”

9Den King Ahab koll di offisa for di kourt kon sey make e go bring Profet Mikaya kom.

10Di two kings wear dia royal robes kon sidan for dia thrones for di gardin for Samaria gate and all di profets bigin profesai for dem.

11One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”

12All di oda profets tok di same tin kon sey, “Make yu go attack Ramot for Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”

13Di ofisas wey go koll Mikaya kon tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”

14But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”

15Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, ‘Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot for Gilead?’ ” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”

16But King Ahab ansa, “How many times I go tell yu sey, if yu dey tok to mi with God name, make yu dey tell mi di trut?”

17So Mikah kon ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, so make dem go dia house with peace.’ ”

18Den King Ahab tell King Jehoshafat, “I nor tell yu sey e nor dey profesai anytin wey dey good for mi? Na only bad tin e dey profesai for mi!”

19Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.

20God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’ “Di angels kon dey tok difren tins,

21until one spirit kom out kon tell God, ‘I go-go deceive am.’

22“God ask am, ‘How yu wont take deceive am?’ “Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’ “So God tell am, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”

23Profet Mikah still sey, “Dis na wetin don happen. God don make dis profets lie to yu. But en ensef don tok sey yu go si wahala!”

24Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”

25Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”

26King Ahab kon give orda sey, “Make una arrest and karry Mikaya go Amon, di ofisas town and Joash, my pikin, dey der too.

27Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”

28Mikaya ansa, “If yu kom back alive, den God nor tok thru mi!” E still sey, “Make all of una hear wetin I tok so o-o!”

29Den King Ahab for Israel and King Jehoshafat for Judah kon go attack Ramot town for Gilead.

30King Ahab tell King Jehoshafat, “As wi dey go di war so, I go shange my klot, but make yu wear yor royal robe.” So Israel king shange kon go di war.

31Siria king don kommand en thirty-two kommanders wey dey use shariot sey make dem nor attack anybody escept Israel king.

32So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut,

33den dem kon know sey e nor bi Israel king, so dem stop to attack am.

34So one Siria soja trow en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!”

35As di war dey kontinue, King Ahab just dey for en shariot face Siria pipol. Di blood from en body kon kover en shariot, so e kon die for evening.

36As evening dey rish, dem kon orda Israel pipol make dem dey go back to dia house.

37Na so King Ahab take die and dem karry am go Samaria go beri.

38Just as God sey e go happen, dem wosh di shariot for Samaria pool where ashawo for dey baf, den dogs kon dey lick Ahab blood.

39Di remainin tins wey Ahab do wen e bi king; with evritin wey e get and how e build big palis and difren towns, dem rite dem for Israel kings history book.

40Ahab die and en pikin, Ahazaya kon take-ova as king.

41For di fourt year wey Ahab bi king for Israel, Asa pikin, Jehoshafat kon bi king for Judah.

42Jehoshafat na thirty-two years wen e start to rule and e rule Jerusalem for twenty-five years. En mama na Azuba, wey bi Shilhi pikin.

43E do like en papa Asa kon dey obey and do only di tins wey God wont, but e nor skata di place where dem for dey woship juju, so di pipol kontinue to burn incense and offa sakrifice to dia juju.

44Jehoshafat make peace with Israel king.

45Di remainin tins wey King Jehoshafat do; with all en good works and di sojas wey e get, dem rite dem for Judah kings history book.

46E remove all di men and wimen ashawo wey dey woship for di juju altars; di ones wey still remain wen Asa, en papa bi king.

47For dis time, Edom nor get king, na govnor dey rule dem.

48King Jehoshafat build plenty big ship wey dey travel go get gold for Ofir, but dem sink for Ezion-Geber.

49Den King Ahazaya wey bi Ahab pikin kon tell King Jehoshafat sey, “Make my men join yor plenty ship,” But Jehoshafat nor gri.

50King Jehoshafat die and dem beri am for en grand-grand papa, David Town. Jehoram en pikin kon take-ova as king.

51For di sevent year wey Jehoshafat bi king for Judah, Ahazaya wey bi Ahab pikin kon dey rule Israel from Samaria.

52E nor obey God and e dey do di kind bad-bad tins wey en papa and mama do. E make Israel pipol sin, just as Jeroboam wey bi Nebat pikin, tell dem to do.

53E woship Baal kon make di Oga wey bi Israel pipol God vex and na so en papa do too.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Kings 22.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.