2 Chronicles 36pcm

1Di pipol for di land take Josaya pikin Jehoahaz kon make am king for Jerusalem.

2Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule three monts from Jerusalem.

3King Neko for Egypt take am go prison kon sey make Judah pipol pay 7,500 pounds for silva and 75 pound for gold as tax to am.

4Egypt king kon make Eliakim wey bi Jehoahaz broda king for Judah and Jerusalem and dem shange en name to Jehoiakim. King Neko karry Jehoahaz go Egypt.

5Jehoiakim na twenty-five years wen dem make am king and e rule eleven years from Jerusalem. E do wiked and bad tins before God.

6King Nebukadnezzar for Babilon attack Jehoiakim, use bronze take shain am kon karry am go Babilon.

7King Nebukadnezzar take some of di tins wey dey God Temple go Babilon kon put dem for en palis.

8Di remainin tins wey Jehoiakim do wen e dey rule, all di big-big sins and bad tins wey e do, dem rite dem for Israel and Judah kings history book. En pikin Jehoiashin kon take-ova as king.

9Jehoiashin na eighteen years wen e start to rule and e rule three monts and ten days from Jerusalem. E nor gri obey God.

10Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.

11Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule eleven years from Jerusalem.

12E do wiked and bad tins for God eyes. E nor honbol ensef to Profet Jeremaya wey bi God savant.

13King Zedekaya attack King Nebukadnezzar wey don make am swear with God name sey e go dey loyal to am. King Zedekaya sturbon well-well and e nor gri turn from sin kom meet di Oga wey bi Israel God.

14All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.

15God wey bi dia grand-grand papa God always dey warn dem, bikos E dey pity for en pipol and Jerusalem wey bi en house.

16But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.

17E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.

18Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.

19Dem burn God Temple kon skata Jerusalem wall. Dem burn all di towns wey dem fence kon distroy all dia betta-betta tins.

20Di king karry all di pipol wey e nor kill go Babilon as slave and dem serve en and en shidren till Persia kingdom start to reign.

21So, wetin God tok thru Profet Jeremaya kon happen. “Dem go abandon di land; di land go rest well-well until di seventy years don komplete just as God tok am.”

22To take fulfil wetin God promise Israel pipol thru Profet Jeremaya, God kon make King Cyrus for Persia rite law give all of dem for en kingdom for di first year wen e start to rule.

23Wetin dem rite na: “King Cyrus for Persia sey: ‘Di Oga God wey dey heaven don give mi all di kingdoms for di world. E don choose mi to build temple for am for Jerusalem wey dey Judah. Naw, make all of una wey bi God pipol go back and di Oga una God go dey with una.’ ”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Chronicles 36.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.