1Josaya celebrate God Passova for Jerusalem. Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di first mont.
2E enkourage di priests kon sey make dem do dia work well for di temple.
3E still tell Levi pipol wey bi tisha for Israel about di tins wey dem dedikate give God sey, “Di holy ark wey Solomon, King David pikin build, make una put am for di temple. Make una nor put am for una shoulder. So, di Oga wey bi una God, na-im and en pipol Israel, una go serve!
4Make una arrange unasef akordin to una family, just as King David for Israel and en pikin Solomon tell una.
5“Make una stand for God house, with di oda Levi pipol and una go ripresent all Israel pipol.
6Make una kill di Passova lamb, dedikate and prepare unasef for una pipol kon do wetin God kommand una thru Moses.”
7Josaya give di pipol 30,000 lamb and goats with 3,000 melu from en animals for di Passova sakrifice.
8En ofisas still use dia mind give di pipol, di priest and Levi pipol some tins too. Priest Hilkaya, Zekaraya and Jehiel wey bi leaders for di temple, give dem 2,600 lamb and yong goats and 300 melu for di Passova.
9Kenanaya and en brodas, Shemaya and Netanel with Hashabaya, Jeiel and Jozabad wey bi Levi pipol ofisas, give Levi pipol 5,000 lamb and 500 melu for di sakrifice.
10Wen dem don arrange evritin for di Passova, di priest and Levi pipol kon stand, take dia pozishon, just as di king tell dem.
11Dem kill di Passova lambs, den di priest sprinkol di blood for evriwhere. Na Levi pipol prepare di animals.
12Den dem divide di burnt ofrin among di pipol akordin to dia family, so dat dem go fit offa dem akordin to di kommand wey Moses give dem.
13Levi pipol roast di Passova lambs just as dem rite am for di Law Book kon boil di holy ofrin inside pots, kettol and pans, den serve di food give all di pipol.
14Afta, dem prepare sometin for diasef and for di priests, bikos di priests wey bi Aaron shidren-shidren, offa burnt sakrifice with di fat till evening.
15Doz wey dey play music with Asaf shidren-shidren face dia own pot, just as King David tok thru Profet Asaf, Heman and Jedutun. Di guards nor komot from dia pozishon, bikos Levi pipol prepare sometin for dem too.
16Dat day, dem prepare evritin to take woship God kon celebrate di Passova, den dem burn sakrifice for God altar, just as King Josaya kommand.
17So Israel pipol for der kon use seven days take celebrate di Passova with di bread wey nor get yist, feast.
18Dem neva do dis kind Passova for Israel since Profet Samuel die. No king for Israel don celebrate Passova like di way King Josaya, di priests, Levi pipol, Israel pipol, Judah pipol and all doz wey dey stay for Jerusalem, celebrate am.
19Dem celebrate dis Passova for di eighteent year wen King Josaya dey rule.
20Afta King Josaya don do all dis tins for di temple, King Neko for Egypt kon go fight with Karkemish for Eufrates River and Josaya kon go try to stop am.
21King Neko send messenjas go meet am sey, “Judah King! Wetin make yu dey oppoz mi? I nor dey attack yu, na di kingdom wey I follow get war I kom meet and God sey make I hurry. God dey my side, so make yu nor oppoz mi or God go distroy yu.”
22But King Josaya nor hear word, bikos e don ready ensef for war. E nor listin to wetin King Neko tok at-all, so e kon go fight am for Megiddo Hill.
23Egypt sojas kon shot King Josaya as dem dey fight, so di king tell en savants, “Make una karry mi komot for here, bikos I don wound well-well.”
24So, en savants karry am for anoda shariot go Jerusalem where e for die. Dem beri am for en grand-grand papa grave and all di pipol for Judah and Jerusalem, kry well-well.
25Profet Jeremaya sing one song for King Josaya and e don turn tradishon for doz wey dey sing for Israel and na both man and woman dey use di song wen dem dey mourn. Dem add di song join di oda mourning songs.
26Di remainin good tins wey King Josaya do as dem rite am for God law book,
27with all di tins wey e gain, from biginnin go rish end, dem rite dem for Israel and Judah kings history book.