2 Chronicles 13pcm

1For eighteen years wen King Jeroboam dey rule, Abijah kon bi king for Judah.

2E rule three years from Jerusalem. Na Maaka wey bi Uriel dota from Gibeah, born am. War kon start between King Abijah and King Jeroboam.

3Abijah attack Jeroboam with 400,000 sojas and Jeroboam get 800,000 sojas.

4Abijah klimb go Zemaraim mountin, for Efraim hill kountry kon shaut sey: “Jeroboam with all Israel pipol, make una listin to mi!

5Una nor know sey di oga wey bi Israel God get agriment with David family sey, dem go rule Israel forever?

6Nebat pikin, Jeroboam fight against David pikin, King Solomon wey bi en masta.

7Leta e gada some yeye men wey tell and make King Rehoboam do some yeye tins, bikos di king heart nor strong rish to tell dem ‘No’.

8“Naw, yu won fight against di royal pawa wey God give David shidren-shidren. Yu fit get plenty sojas and yu karry gold juju as yor god.

9Shebi yu porshu Levi pipol and God priest wey bi Aaron shidren-shidren? Yu put doz wey nor suppose bi priest for dia place, just as oda nashons dey do. Anybody wey kom with seven melu or seven ram fit bi priest for dat fake juju wey yu koll god.

10“But for us, na di Oga bi awa God and wi nor go ever rijet am. Na Aaron shidren-shidren bi God priests and Levi pipol dey assist dem.

11Dem dey give God sakrifice wey get betta fine smell both for morning and evening. Dem dey gi-am bread ofrin for klean tabol kon lite di lamp put for di gold lampstand for evening. Wi dey do wetin God sey make wi do, but una don rijet am.

12Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”

13But Jeroboam don send some men go attack Judah sojas from dia back. Di real sojas dey for front, while Judah sojas dey for back.

14Judah men turn kon si sey dem dey attack dem both from front and back. Dem kry to God for help and di priests blow dia trumpet.

15Judah men and King Abijah wey dey lead dem kon shaut kry give God, so God kon help dem win Jeroboam and Israel sojas.

16Israel pipol run from Judah sojas and God kon let Judah men win dem well-well.

17Abijah with en sojas win dem well-well, dem kill 500,000 strong Israel sojas.

18So Judah men win Israel pipol, bikos dem trust and bilive dia grand-grand papa God.

19Abijah porshu Jeroboam and en sojas kon take Bethel, Jeshanah and Efron.

20Jeroboam nor ever get pawa again durin di time wen Abijah dey rule. Afta, God kon kill Jeroboam.

21Abijah get pawa well-well, e get fourteen wifes, twenty-two sons and sixteen dotas.

22Di remainin tins wey King Abijah tok and do, dem rite dem put for Profet Iddo book.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 2 Chronicles 13.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.