1 Kings 18pcm

1Afta sometaim, for di third year wey rain nor gri fall, God tell Elijah, “Make yu go meet King Ahab and I go make rain fall.”

2So Elijah go meet King Ahab. Dat time, e nor dey eazy to plant food for Samaria.

3So Ahab koll Obadaya wey dey kare for di palis. Obadaya dey serve God with all en mind.

4Wen Jezebel dey kill God profets, Obadaya hide hundred profets for two kave; fifty-fifty for each kave and e dey bring food and wota kon give dem.

5King Ahab tell Obadaya, “Make yu go all di land; pass thru di wota and di valley kon shek weda yu go si any aria wey grass dey, so dat di animals go-go chop for der, make dem nor for die.”

6Ahab and Obadaya kon divide di land among demsef. One go dis side, while di oda one go di oda side.

7As Obadaya dey go en side, Elijah kon si am. As Obadaya notis sey na Profet Elijah, e fall face groun kon sey, “My oga, Elijah! Na yu really bi dis?”

8Elijah ansa, “Yes! Na mi. Make yu go tell yor oga sey, ‘Elijah don kom back.’ ”

9Obadaya kon sey, “Wetin I do wey make yu wont make King Ahab kill mi yor savant?

10As long as yor Oga my God dey alive, I dey tell yu sey, my oga don send pipol go evriwhere go find yu. Wen dem tell am sey, ‘Yu nor dey der,’ e go make sure sey dem swear sey dem nor really si yu.

11Naw, yu dey sey, ‘Go tell yor oga sey, “Elijah don kom back.” ’

12But wen I leave yu, God Spirit go karry yu komot sotey I nor go si yu again. If I go tell King Ahab sey I don si yu, den e find and nor si yu, e go just sey make dem kill mi. Dat one nor good, bikos yor savant dey serve God well-well, since wen e bi small pikin.

13And na true sey, my oga know wetin I do wen Jezebel dey kill God profets. I hide hundred profets for two kave, fifty-fifty for each kave and I dey give dem wota and food.

14Naw yu sey, ‘Go tell yor oga, “Elijah don kom back.” ’ But e go kill mi.”

15Elijah kon sey, “As long as God wey get pawa wey I dey serve dey alive, I go let King Ahab si mi today.”

16Wen Obadaya go tell King Ahab wetin Elijah tok, di king kon go meet am.

17Wen Ahab si Elijah, e tell am, “Na yu really bring dis wahala kom Israel?”

18Elijah ansa, “I nor bring wahala kom Israel. But na yu and yor papa family bring wahala as una abandon God kommand kon follow Baal.

19Naw, send message go gada Israel pipol kom meet mi for Mount Karmel with Baal 450 profets and Asherah juju 400 profets wey Jezebel dey support.”

20King Ahab send message go meet Israel pipol and dem gada all di profets for Mount Karmel.

21Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!” But di pipol nor tok anytin.

22Elijah kon tell dem, “Na only mi bi God profet wey remain, but Baal profet na 450.

23Make dem bring two melu kom give us. Dem go choose one for diasef, kut am into pieces kon put am for di wood. But dem nor go put fire. I go do di same tin to di oda melu and I nor go put fire too.

24Una go koll una god name and I go koll my God name. Den, di one wey go ansa with fire, na-im bi di true God.” All di pipol ansa, “Dis test na good one.”

25Elijah tell Baal profets, “Make una first choose one among di melu kon start, bikos na una plenty pass. Make una koll una god name, but make una nor lite fire put.”

26So dem take one melu as Elijah tok kon kill-am put on-top di firewood wey dem arrange. Dem koll dia juju, Baal name from morning go rish aftanoon kon dey sey, “Baal! Make yu ansa us o-o.” But e nor ansa dem, even as dem dey jump anyhow for di altar wey dem make.

27For aftanoon, Elijah kon dey laf dem dey sey, “Make una shaut well-well. Afta all, na god e bi, may bi e dey tink or waka go out or travel. May bi e dey sleep and e nid pesin wey go wake-am up.”

28So dem shaut well-well, just as dem always dey do for dia juju. Dem use spear and swod dey kut demsef, until blood bigin komot from dia body.

29Dem shaut and kry till aftanoon, but dem nor hear any sound, ansa or anytin.

30Elijah kon tell di pipol, “Make una kom meet mi.” So all di pipol go meet am. E ripair God altar wey don skata since.

31Den Elijah karry twelf stones wey stand for Jakob twelf tribes wey God tell sey, “Na Israel go bi una new name.”

32E kon use di stones make altar give God. E dig one big gutta round di altar wey go kontain four gallon of wota.

33E arrange di firewood kon kut di melu put on-top. Den e sey, “Make una fetch wota put for four gallon kon pour am on-top di ofrin and wood.” So den do as e tok.

34Den Elijah sey, “Make una do am again and again.” So dem do am three times.

35Di wota rush kom down from di altar kon full di gutta.

36Wen time rish to do di evening ofrin, Profet Elijah waka go di altar go pray, “My Oga God wey bi Abraham, Isaak and Israel God! Make Yu show today sey, na Yu bi Israel God and I bi yor savant wey dey do di tins wey Yu kommand.

37My Oga God! Make Yu ansa mi! Ansa mi, so dat pipol go know sey na Yu bi di true God, den dem go turn from dia sins kom meet Yu.”

38At wons, fire from God kon fall from heaven. Di fire burn di ofrin, di wood, di stones and di dirty kon dry di wota wey dey di gutta.

39Wen di pipol si dis tin, dem fall face groun kon dey sey, “Na God bi di true God! Na God bi di true God!”

40Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.

41Den Elijah tell King Ahab sey, “Make yu go drink and chop, bikos yu go soon hear heavy rain as e dey kom.”

42So King Ahab go chop and drink and Elijah klimb go Mount Karmel. E bend kon put en face for en leg centre, den e kon dey pray.

43Leta e tell en savants, “Make yu go look di side wey di sea dey.” So di savant go look am kon kom back sey, “Nor-tin dey der.” Elijah kon send am go look again for seven times.

44For di sevent time, di savant kon tell am, “I si one small kloud wey bi like pesin hand dey raiz from di sea.” Elijah kon sey, “Make yu go tell King Ahab sey rain dey kom. Make yu go with di shariot, so dat di rain nor go meet yu for road.”

45So dark kloud kon kover di sky; di wind blow and heavy rain bigin fall. King Ahab ride dey go Jezrel.

46Naw God give Elijah pawa, so e tie en rope round en waist kon run with leg pass Ahab go Jezrel.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for 1 Kings 18.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.