1For eighteen years afta Jeroboam don bi king for Israel, Abijah kon bi Judah king
2and e rule Jerusalem for three years. En mama na Maaka wey Absalom born.
3E kommit sin like en papa and e nor gri respet di Oga wey bi God, just as David en grand-grand papa respet am.
4But bikos of David, Oga God kon give Abijah one son wey go rule Jerusalem afta am.
5God do like dis, bikos David do wetin E like and e nor disobey any of en kommand, apart from Uriaya from Hit wey e kill.
6All di time wen Abijah bi king, na so-so war e dey fight with Jeroboam.
7Evry oda tin wey Abijah do, dem rite am put for Judah kings history book.
8Wen Abijah die, dem beri am for David Town and en pikin Asa kon take-ova as king.
9For twenty years afta Jeroboam don bi king for Israel, Asa kon bi king for Judah
10and e rule Jerusalem for forty-one years. En mama too na Maaka wey Absalom born.
11Asa obey God, just as en grand-grand papa David do.
12E drive all di men and wimen wey dey do ashawo work for where dem for dey woship juju kon skata di juju wey di former kings make.
13E remove en mama Maaka, as kween moda, bikos e dey serve Asherah juju. King Asa skata di juju kon burn am for Kidron Valley.
14Even doh King Asa nor skata evriwhere where dem for dey serve juju, e still dey faithful to God till e die.
15All di tins wey en papa dedikate give God; di silva and gold wey en ensef dedikate, e put dem for di temple.
16All di time wey King Asa for Judah and King Baasha for Israel dey rule, na so-so fight dem dey fight demsef.
17King Baasha skata Judah kon put sojas for Rama, so dat nobody go fit enter or go out from Judah.
18So, King Asa karry all di silva and gold wey remain for di temple and di palis kon give dem to some of en ofisas with dis message, go Damaskus go give King Ben-Hadad for Siria. Na Tabrimmon bi Ben-Hadad papa and na Hezion born Tabrimmon.
19Di message wey e send go na: “Make wi bi friends, just as awa papa dem bi. Dis silva and gold na di gift wey I give yu. Make yu nor bi friend with King Baasha for Israel again, so dat e go remove en sojas from my aria.”
20King Ben-Hadad agri with wetin King Asa tok and e send en soja kommander make dem go attack Israel town. Dem attack and katch Ijon, Dan, Abel-Bet Maaka; di arias near Galilee wotaside and evriwhere for Naftali.
21Wen King Baasha hear wetin happen, e pak en sojas from Rama kon go Tirzah.
22Den King Asa send message go evriwhere for Judah sey make evribody help am karry di stones and timbas wey King Baasha take fence Rama komot. Asa kon use di tins take fence Mizpa and Gibeah wey bi towns for Benjamin aria.
23Dem rite evry oda big tin wey King Asa do, plus di towns wey e fence, for Judah kings history book. But wen e don old, e kon get diziz for en leg.
24King Asa die and dem beri am for di royal grave for David Town and Jehoshafat, en pikin kon take-ova as king.
25For di sekond year wen King Asa don dey rule Judah, Nadab wey bi Jeroboam pikin kon bi king for Israel and e rule for two years.
26E sin against God, just as en papa Jeroboam do.
27Baasha wey bi Ahijah pikin, wey kom from Issakar tribe kon plan against Nadab and e kill-am wen en and en sojas won take-ova Gibbeton for Filistia.
28Dis tin happen for di third year wen Asa bi king for Judah. So Baasha take-ova from Nadab as Israel king.
29At wons, e bigin kill all Jeroboam family. So dat wetin God tok thru Profet Ahijah from Shiloh, go happen. Dem kill evribody for Jeroboam family and no one remain.
30Dis tin happen, bikos Jeroboam make di Oga wey bi Israel God vex, with di sins wey en and Israel pipol kommit.
31Evry oda tin wey Nadab do, dem rite am for Israel kings history book.
32Thru-out di time wen King Asa for Judah and King Baasha for Israel dey rule, na so-so fight dem dey fight.
33For di third year wen Asa don bi king for Judah, Baasha wey Ahijah born kon bi king for Israel and e rule from Tirzah for twenty-four years.
34E nor obey God at-all and e make Israel pipol sin, just as Jeroboam do.